Makinde suspend field trips for schools as teacher, victim of Oyo bandits attack get burial

Di deadly ontop schools for Oriire Local govment area don make Oyo state govnor Seyi Makinde take some kain decisions since di attack happun.
Di Oyo govment on Tuesday announce di suspension of all school excursions, field trips, sports competitions and oda activities outside school premises.
Dis dey come one day afta oga Makinde sign executive order to regulate di activities of associations and groups wey dey perform security-related services for di state.
Di govnor don ask leaders of dis different security outfits for di state make dem register wit di state govment formally and wear uniform as a means of identity within di state.
"In view of di recent security concerns, di Ministry dey take steps to safeguard di lives of students and members of staff for all schools in Oyo State," di ministry of Education write for circular to schools.
Dem add say, "All School Administrators dey hereby directed to suspend all excursions, field trips, sports competitions and any oda activities wey require to dey move students outside school premises until further notice.
Di burial of di school teacher, Joel Adesiyan wey gunmen kill hold for Oyo state, as friends, family members, colleagues and sympathisers gada to say dia final goodbye.
Di funeral of di school teacher for Community High School hold for Ayegun Baptist Church for Ogbomosho on Friday.
Family, friends and many sympathisers attend di funeral service wia many dey cry, dey shed tears and show dia emotions as di funeral service dey happun.
Afta di church service dem move im body go burry.
Wetin lead to di death of Joel Adesiyan?

Last week, gunmen attack three schools across Esiele community for Oriire Local govment of Oyo State.
Tori be say di terrorists ride motorcycle into di community to kidnap schoolchildren and teachers from Community High School, Ahoro-Esinele, and Yawota Baptist schools.
Di gunmen kill one teacher during di attack, kidnap di school principal, and kidnap schoolchildren from Community High School.
Di Oyo State Police tok-tok pesin, Ayanlade Olayinka tok say "Gunmen storm Ahoro-Esinele area, Oriire local government area, Oyo state. Dem kidnap school principal and unknown number of students," di police tok.
Ayanlade tok say di gunmen storm di school around 8:00 and 9:00 GMT on 15 May.
Di students bin dey perform song wen di gunmen attack di school and dem begin dey shoot.
How Oyo state govment and di president react to di attack
President Bola Tinubu condemn di kidnap of school teachers and children from three school for Oriire Local Government Area for Oyo State.
Inside one statement by di presidency, di president tok say security operatives go rescue all di remaining victims while e charge di national assembly make dem do quick enact di law for di creation of state police.
Di president also condemn di death of one of di teachers wey gunmen kill afta dem kidnap from Esiele community for Oriire Local Government Area for Oyo State.
"Di National Assembly go accelerate di enactment of di law wey go create state police", di president tok.
Di president describe di incident as "barbaric" and expressed sympathy to di families wey dey affected and di state govment.
"I dey sad about di killing of one of di teachers wey dem kidnap by di gunmen wey invade di community. I sympathise wit di govnor Seyi Makinde and I dey commend di steps wey e don take on top dis matter. I sympathise wit di families of di victims wey dem kidnap," di statement tok.
Di president tok say dem dey work wit Oyo State government to rescue all di victims while e praise di inspector-general of police and di police commissioners for Oyo and Kwara States for dia quick response and the deployment of tactical team and di ntelligence Response Team (IRT) to go rescue di victims.
Tinubu tok say wit di high cases of kidnapping wey dey happun e don clear say need dey to set up state police to manage some areas wey no get enough security
"Di IGP, base on my instructions, dey lead di tech-driven operation. We dey expect breakthrough soon. Dem go catch di bandits and all dia local collaborators and dem go face di law," di president tok.
Also, di govnor of Oyo state tok say dem don start to use both kinetic and non-kinetic approach to respond to di situation, and security agencies dey under pressure to rescue di remaining victims.
"We don decide say we go use no be only kinetic approach. Some leaders, elders and religious elders especially from Baptist, wey dey among di school. I wan make appeal. We no take dis matta lightly. I dey appeal to everybody, citizens, residents, especially di local govment and di rest of Oyo States," Seyi Makinde tok.
"I wan make appeal say we go do everytin wey dey within our power to make sure say we resolve dis matta quickly and we go bring our children safely. But e no dey easy and e dey challenging," e tok.
Di Oyo state chapter of di teachers union, don protest against di attack on school teachers and students while dem demand for di release of dia colleagues and di children.
Di teachers also demand for betta security across school in di kontri.
About Joel Adesiyan?

Wia dis foto come from, Family
Mrs Comfort Adesiyan born Joel Adesiyan on 11 December 1976 for dia family Compound, Oko-Ile, Ogbomoso.
E attend L.A. primary school, Oko-Ile, Ogbomoso, afta dat e attend Ogbomoso Baptist High School for secondary school education an den Ado-Ekiti State University, wia e graduate wit degree in BSc.
E marry im wife, Mrs Victoria Adesiyan, on 18th April, 2008.
Late Mr Adesiyan dedicate im life to teaching work. For 2005, dem appoint am as primary school teacher for Oyo State Teaching Service.
E serve as a school teacher for Igboho in di year 2005 to 2012 bifor dem transfer am go Bolorunduro Community Primary School, Oriire Local Government, wia e dey teach until 2024.
E also serve as Chairman of Ebun Olorun Society for Ayegun Baptist Church Ogbomoso from 2016 to 2020. Afta dat, e serve as di financial secretary of Ebun Olorun Society from 2025 until im die.









