Nigeria govment tok wetin go happun afta 30 days of NNPC fuel price discount

Nigeria minister of Finance siddon for black chair, e wear grey colour suit wey get stripe wit white shirt and brown tie wey get flower design.
Wetin we call dis foto, Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy
Published
Read am in 5 mins

Nigeria Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy Taiwo Oyedele don tok about di next step for commercial drivers for di kontri afta di Nigerian National Petroleum Company (NNPC) 30 days for fuel price discount finish.

On 9 October, 2026, Nigeria govment bin announce discount for one month for all NNPC outlets for di kontri.

Na di Minister of Finance and Coordinating Minister of di Economy, Taiwo Oyedele, bin announce dis new policy.

Im tok say di price reduction no be part of govment economic reforms but na sake of di crisis for Iran wey start about eight months ago.

"Bifor di crisis start, like say Nigeria bin no start di reforms e for no fit stand gidigba, na di reforms prepare us so dat we fit handle di shock."

According to am, Nigeria govment bin do plenti tins but tins bin go out of hand in di last one month especially wen dem bin tink say Iran and US go settle di mata but e no work like dat.

"Na wen we see di jump for pump prices na im we decide to do sometin about am but we also dey sure say we no dey bring back subsidy becos e no dey sustainable.

Im tok say na NNPC retail wey be part of di NNPC subsidiary set up about 24 years ago becos pipo bin dey hide di product and dem bin no dey distribute across di kontri na why e bin mno dey work commercially.

Im explain say wen Nigeria bin turn 66 years for 1 October , NNPC tok say dem wan give discount of 66 naira if you download app, so na marketing strategy e be and promo.

Im add say govment later call NNPC say dem wan turn dis dia promo to support.

"We tell dem to extend am for 30 days and make dem limit di amount of discount to your retail margin wey be di profit you dey make and make dem prioritise public transporters. Na wia di support aspect come in."

As e make di announcement e make am clear say na discount no be subsidy and no be for evri filling station di discount go apply.

Since dem announce dis discount, commercial drivers for parts of di kontri dey lament say notin don change for fuel price and dem no know wetin go hapun afta 30 days pass.

"Afta 30 days, NNPC go do dia review and share di report wit us and den we fit discuss again maybe by di 30 days if e dey within di range wey we dey now no need to do anytin but if need dey we gho re-examine am."

Our reforms na for average Nigerians

E admit say some of di policies of govment dey affect di citizens sake of say e come wit some difficulties but di govment dey show support.

For exclusive interview wit di BBC im tok say wetin dem dey do na to tell Nigerians say dia politices dey work.

"Like say we no get subsidy removal today wit crisis around di world we for dey struggle wit supply. Dangote factory for no dey becos na di reform wey create di environment wey make di investment stand.

"Di time wey di naira floatation hapun we bin dey run out of dollars, di external set balance bin dey around three billion, recently di Central Bank say e dey under one billion dollars. So e for be more pain and economic devastation. E no make di pain easy but e mean say beta understanding dey."

Oga Taiwo tok say dem don pass di stage wey dem go dey tell pipo to dey patient from sacrifices to wia dem go begin see result and di reforms na about average Nigerians.

"Wen we bin do our scorecard di first tin you bin see na salary increment and dat one na for average Nigerians.

Nelfund don help more dan 1.5 million students, dem be average Nigerians. We don give significant amount of credit for small businesses under di bank of Industry, now also bank of Agric, average Nigerians.

Im explain say wetin govment do wit di reforms bin save 27 states wey bin dey owe salary and pension.

"So di pension wey dem bin pay, gratuity, retirement benefits, dem go to average Nigerians.

Oga Taiwo say wetin dem dey try to do now na to make sure say di impact waka fast-fast so dat average young pipo for Nigeria go get good job and market pipo fit do dia job and businesses becos light dey.

Transportaion go dey available so dat pipo fit dey wia to stay.

"Phase one for correction, phase two na to stabiloise and phase three na to accelerate growth."