Who be Geoff Ogunlesi wey marry American jewelry designer Jennifer Meyer

Wia dis foto come from, Stefanie Keenan/Getty Images for Baby2Baby
Geoff Ogunlesi marry im longtime sweetheart Jennifer Meyer on Saturday for Hawaii, United States
Geoff na di son of Nigerian billionaire lawyer and investment banker Adebayo Ogunlesi and im marry Jewelry designer Jennifer Meyer for Four Seasons Resort Lanai for Hawaii.
Meyer ex-husband, Tobey Maguire na im officiate di wedding ceremony afta imsef and Meyer bin finalise dia divorce for September.
Hollywood A-list celebrities, Leonardo DiCaprio, Jeff Bezos, Lauren Sánchez Bezos and Courteney Cox dey among di pipo wey dey present for di wedding.
Ogunlesi and Meyer confam di birth of dia baby for June dia year.
Geoff na di founder of The Ogunlesi Group, one entertainment management company for Los Angeles.
E start di company for 2022, as e dey build im career for music industry.
Di company dey manage artists like Young Thug, charlieonnafriday, Myles Frost and Alabama Barker.
Geoff na from di prominent Ogunlesi family and im papa, Adebayo Ogunlesi, na Nigerian billionaire lawyer and investment banker wey pipo know for im work for global finance.
Geoff start im career for major music company. E serve as A&R consultant for Warner Music Group from 2013 to 2014, bifor e join 300 Entertainment. E spend almost nine years for dia. Afta e gada experience for artist development and music business, e start im own venture.
Geoff attend Hotchkiss School, wey be boarding school for Connecticut, bifor e graduate from Amherst College for Massachusetts, according to im LinkedIn profile.
Im don work wit many artists for di industry and im link up wit Meyer for 2023.
Meyer announce dia engagement for social media for 2024.
Who be Adebayo Ogunlesi?

Wia dis foto come from, Michael Nagle/Bloomberg via Getty Images
Bayo Ogunlesi na banker wey hail from Ogun State, southwest Nigeria and im get about $106bn in assets.
At 70 years old, di founder and current CEO of Global Infrastructure Partners (GIP) make di record transaction afta e sell im investment company to BlackRock.
Ogunlesi obtaim im Bachelor’s Degree for Philosophy, Politics, and Economics for Oxford University. After dat, im go di United States for two more degrees for Harvard.
E start im career as di first non-American clerk for US Supreme Court judge and den become lawyer for di Cravath, Swaine & Moore law firm for New York,
Ogunlesi den enta banking for Credit Suisse First Boston for 1983.
For 2006, Ogunlesi join oda five investment partners – Jonathan Bram, Matt Harris, Michael McGhee, Bill Woodburn and Raj Rao.
And dem later buy London City Airport for dia first year, den take over Gatwick, di second airport for UK for 2009. Di deal of about £1.5bn ($1.9bn) open door for oda big takeovers, including Edinburgh Airport for Scotland and Sydney Airport for Australia.




















