Fubara withdraw from Rivers state 2027 governorship election

Wia dis foto come from, Sim Fubara/Facebook
Di politics of Rivers State don take new angle as govnor Siminalayi Fubara announce im withdrawal from di APC governorship primaries wey go hold on Thursday 21 May, 2026
For statement wey e sign by imsef, Fubara say e go support who ever go emerge as di candidate of di party.
E say leadership dey about sacrifice and "e get wen time go come wey personal ambition must submit to di greater good of di pipo."
Govnor Fubara say Rivers state big pass any individual and for dis critical moment, "di peace, stability and unity of our dear state must take precedence over evri personal interest."
Di govnor thank all im supporters say e understand dia disappointment, anger and pain as dem don sacrifice many times along di way but say make dem know say im silence over dis period bin dey "deliberate and strategic, guided always by higher interest of our state and our pipo."
"Make e dey clearly understood say pesin step aside from participating for di upcoming Rivers governorship election no be out of weakness, fear or surrender but out of conviction and sacrifice so Rivers State fit move forward in peace and unity and I remain committed to serve di good pipo of Rivers State to di end of my term."
Governor Fubara na di second pesin to step aside from di APC primaries afta Tonye Cole.

Wia dis foto come from, Tonye Cole/Facebook
Tonye Cole wey don be APC candidate before, for di 2023 election explain say di national leadership of di APC bin hold a critical stakeholder meeting wia dem discuss serious tins about di future if di Rivers APC and importance of presenting one united front ahead of di primaries and di 2027 general elections.
"Sake of dat meeting and afta extensive consultations wit members of my political team, associates, supporters and oda key stakeholders, I don take di decision in di overriding interest of party unity, peace and collective progress to respect di supremacy of di party and withdraw from di forthcoming primaries."
Wit dis withdrawals, di contest for di Rivers APC governorship candidate go likely dey between Ogundu Kingsley Chinda and Alabo George Dakorinama Kelly.










