Tinubu appoint six new top Inec officials

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
Nigeria President Bola Tinubu don appoint six new senior officers for di Independent National Electoral Commission (Inec), "to fill vacancies created by expiring tenures", Presidential tok-tok pesin Bayo Onanuga announce for one statement on Friday.
Di nominees include four new national commissioners and two new resident electoral commissioners.
Dis nominees go still undergo screening by di Nigeria Senate bifor dia appointment go bicom effective.
Di development dey come exactly three months to di 2027 general elections wey according to Inec timetable go start on 16 January.
Di new nominees na Professor Mustapha Aliu to represent di North West region; Bashir Muhammed Umar for di North Central; Bala Bila, reappointed to keep representing di North East; and Oluwatoyin Babalola for di South West.
Also di two new Resident Electoral Commissioners na Samuel Akinjide Akinleye for Ekiti State, and Zahradden Basiru Sanusi, for Jigawa State.
Di president ask di Senate to speed up di screening process for di nominated individuals sake of di forthcoming elections.
Meanwhile, some Nigerians wey react to di announcement on top social media express doubts at di timing of di appointments and becos of di fact say di president wey dey make di appointments dey contest for office in di elections.
Vincent Ilomechina write for X: "Nigeria gatz to, as a mata of national interest, draft new legislation to appoint electoral umpires. Di president no suppose dey appoint umpire for game wey e dey take part in."
Anoda X user wey im name na simply Larry also tok say: "I tell una say not until inec bicom really independent... Until den, e no get anytin like free and fair election for Nigeria."
However, Modupe Adeboye-Ayoroh, get a slightly different opinion as she write say: "Dis na nomination, no be appointment, di Senate still gatz to scrutinise. As Nigeria dey progress, we go arrive for di point for law wia di President go leave di duty of nominating electoral commissioners to di Senate."





















