How 16-year-old shoot and kpai three children and one teacher for US primary school

Wetin we call dis Video, "E hard to believe" – How di shooting for Oregon primary school take happun
    • Author, Rebecka Pieder
  • Published
  • Read am in 5 mins

One 16-year-old boy don shoot dead three children and one teacher for one primary school for Oregon state, US, bifor one bystander kpai am, police tok.

Police say di suspect, wey dem never release im name, force im way enta Silver Rail Elementary School for Bend city on Thursday afternoon afta e shoot at di locked doors of di school.

One member of di community later shoot di teenager dead, e "pursue am into di school and engage am", Krantz tok. Police arrive three minutes later.

Di three children wey die dey di age of five, eight and 11. Dem dowey dey for critical condition go hospital.

E neva dey clear if di attacker get any connection to di school.

“We dey shocked and heartbroken by dis senseless tragedy,” Steven Cook, di top administrative official of di local school district, tok for one statement.

“No words fit adequately express di grief wey our community dey experience.”

Two men dey stand for di lower-left corner, wearing bullet-proof vests wey get “sheriff” written on dem. For di background, one green building wey get wooden panels dey stand, and di school name dey written on am.
Wetin we call dis foto, Dem shoot kill di suspect few moments afta local law enforcement officers arrive for di scene

Wetin police tok

Police tok say di attacker na 16-year-old boy wey dey live for di area, but dem no release any more details about am or di identity of di victims.

Dem alert police about one active shooter for Silver Rail Elementary at 12:59 local time (19:59 GMT), Bend Police Department tok-tok pesin Sheila Miller tell tori pipo.

Police say di first call bin come from one pesin wey report say one unknown suspect dey shoot at im car wit one long gun. Fotos wey dem release from di scene show one red truck wey get bullet holes.

Few minutes later, di local county dispatch centre receive 911 calls wit report say di attacker don enta di school.

Police say e shoot at di locks for di doors to force im way inside.

Local media reports suggest say di school receive new classroom doors for 2022, wey pesin fit lock by simply pressing one switch.

One bystander wey see di shooting begin unfold, pursue di attacker enta di school and shoot am dead, police explain.

Three minutes later, first officers land for di scene. Dem confam say di attacker don kill pipo, and dem search di school.

Oregon Govnor Tina Kotek hail di pesin wey “heroically intervene” to stop more pipo from losing dia lives.

“Wetin you do carry heavy emotional burden, and I just want make you know say my thoughts dey wit you too,” she tok during one media briefing alongside oda officials.

One map dey show wia Silver Rail Elementary School dey for Bend, Oregon, US.

One local newspaper tori pesin tell BBC Radio 4 Today programme say di school dey under lockdown during di shooting and students fit communicate wit dia parents wey dey outside through dia Apple watches.

Michael Kohn, one tori pesin wit Bulletin newspaper, tok say parents dey shocked sake of di incident.

“Dis na one neighbourhood school. Parents dey shocked. Na sometin wey you no expect to happun for Bend, Oregon. Na one town wey dey for mountainous area,” e tok.

Dem close schools for Bend on Friday. Officials say di community need time to heal.

Police say about 450 children dey attend Silver Rail Elementary School, wey get more dan 40 adult staff members.

According to di K-12 School Shooting Database, 235 shooting incidents happun for American schools last year, while at least 140 don happun so far dis year.

Pesin wey neva reach 18 years no fit buy firearm for Oregon, but di state allow children and teenagers to possess firearm wit permission from dia parents or guardians.

Di state also allow pesin to temporarily give firearm to a minor for hunting, target practice or any oda lawful purpose.

Officials no gree disclose di exact type of weapon wey dem use for di attack or how many bullets dem fire.

Several law enforcement sources tell CBS News say di suspect use shotgun.

Oregon don pass different gun safety laws for recent years, but di rate of gun violence for di state dey close to di US average, with 14.2 deaths for evri 100,000 residents, according to gun safety advocacy group Everytown for Gun Safety.

Two pipo dey hug each oda while three women dey look dem. All of dem look serious and dey wear light jackets.
Wetin we call dis foto, Pipo dey attend one community vigil for Drake Park afta di shooting