Police react to panic for Ogbomosho over fake tori of new bandit attack, Makinde give update

Wia dis foto come from, NPF/Facebook
- Author, Gift Andrew
- Role, Reporter
- Published
- Read am in 3 mins
Police for Oyo state don release statement say no be true say armed bandits land for Ogbomoso and wan kidnap school children for di city.
Dis dey come after panic shele for di area and make pipo to schools to withdraw dia children from schools unto say dem dey fear bandits attack.
Videos wey BBC sight show as plenty pipo dey run up and down for di city, plenty of dem na young school children and dia parents.
Voice wey dey tok for di video claim say parents dey withdraw dia pikin dem from school sake of bandits.
Rumour for town Tuesday morning be say di bandits attack one school Are-Ago High School, Ogbomoso.
For statement, police say dem deploy officers to di school and tok wit di school Principal Mrs Akanbi Ruth wey confirm say rumour come from students wey see unfamiliar faces behind di school fence.
According to di statement, di presence of di unfamiliar faces raise suspicion among di school children and teachers and cause panic in di school environment.
Police say wen dem question di individuals behind di school, dem confirm say na one officer of di Nigeria Security and Civil Defense Corps NSCDC Kwara state command wey dey inside SUV car with him friends, say dem come di area to see dia friend wey dey do her birthday.
Dem say dem reach out to di NSCDC Ogbomoso office to confirm di identity of di men and get confirmation say dem Dey legit.
Dis Tuesday incident dey shake di town sake of di kidnapping incident wey happen for Oyo state over di weekend wia gunmen strike and kidnap school children and teachers for di Ahiro-Esinele community of di state.
Rumor bin spread on Monday say di kidnappers cut off di head of one of di school teachers. Authorities never confirm di beheading.
For statement on Govnor of di state Seyi Makinde say na total of 32 pipo dem kidnap, say seven teachers and 25 pupils.
Di govnor say dem dey intensify efforts to rescue di victims, say him don meet with service chiefs for di state sake of di matter. E say dem dey reassemble di state security surveillance aircraft for Lagos to use run operations soon.
Nigeria president for statement condemn di attack and di killing of di school teacher.
Sake of di weekend incident, school teachers for Oyo State do protest.
Di protest happun for Monday for Ogbomosho and na members of di state Teaching Service Commission (Tescom), di Nigeria Union of Teachers (NUT) and oda labour groups follow do di protest.
Di teachers dey demand for betta security and dem dey show support for dia colleagues wey di bandits don hold captive since Friday.
Afta di news break, di Oyo State Universal Basic Education Board (Oyosubeb) close all primary schools for di neighbouring communities on Friday.








