BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Five key points from Trump UN General Assembly speech
US President Donald Trump deliva ogbonge speech for di ongoing 2026 United Nations General Assembly for New York.
Wetin be Rainbow Coalition and why APC govnors dey quarrel FCT Minister Nyesom Wike bicos of am?
As di 2027 presidential election dey near for Nigeria, politicians from di ruling party dey clash wit Nyesom Wike, a cabinet minister wey belong to di opposition party.
Why Tinubu no go attend UN General Assembly for di US and wetin e mean for Nigeria?
Nigeria Ambassador to di United Nations, Jimoh Ibrahim, say Nigeria go kontinue to retain special seat and status for UNGA, even though Vice President Shettima go represent President Tinubu.
How to stay safe as Nigerian govment agency say thousands of communities go see ogbonge flood within next seven days
According to di advisory by di agency, di 15 states wey dey likely to experience dis flood include Lagos, Rivers, Cross River, Delta, among odas.
Ex-husband of woman wey kpai dia three children explain why e forgive am
Di husband of di US woman wey strangle her three young children dey talk about im grief for interview wit CBS News.
Nafdac find methanol and cannabis for inside di herbal drinks wey kpai 48 pipo for Ondo state
Methanol na one highly toxic substance wey dey cause blindness, organ failure, and death.
'Dem allegedly spray Niger state miners wit unidentified substance bifor dia deaths' – Govnor Bago
Govnor Bago hala say e bin no know say dem dey make arrests for di state but na afta di tori of di deaths, im jump to action to carry dem go hospital.
'No make life unbearable and distribute bags of rice' - Atiku tell Tinubu
Atiku tell President Tinubu say make e no make life unbearable for Nigerians and begin distribute bags of life.
Tinubu order prosecution of officials wey get hand for di deaths of suspected illegal miners for Niger State
Nigeria civil defence say more dan 50 chop arrest during di operation earlier dis week.
How Nigeria win $3.38bn battle for 1500MW Mambilla Power Project
Nigeria govment win international court mata wey don dey for more dan nine yeaes, ova di 1500MW Mambilla Hydroelectric Power Project for Taraba State.
Special Tori
Wetin we know about di US-based Ghanaian professor wey die afta im wife allegedly shoot am
Wife of one Ghana professor for di US dey face murder charges afta she allegedly shoot am. Police say di couple bin dey separated for two years wey dem bin dey di middle of divorce.
South African police arrest suspects wey dey linked to one of di deaths of women for Gauteng Province
Di police for statement on Monday, 21 September announce say dem arrest one man and two women dem suspect say get hand for di bodi of di ninth woman wey dem kill and dump her bodi for Dawn Park.
'Each Witness gatz decide' - Jehovah Witness announce new change on blood transfusion and donation
Di governing bodi decision to let dia pipo to accept parts of wetin make di blood wey include red cells, white cells, plasma or platelets.
Wetin dey inside di deal US and Denmark reach ova Greenland afta Trump threats
Di announcement dey come months afta Trump threaten to "take" Greenland sake of national security concerns.
Donald Trump say e dey ban CNN, MS NOW and Politico from White House
Dis na di latest twist for im cat and rat relationship wit American media.
University of South Africa condemn xenophobic attacks on oda Africans as Nigeria evacuate more citizens
"We belong to di African intellectual community wey dia strength dey come from di movement of ideas, pipo, knowledge and experience across di African continent," University of South Africa tok.
South Africa find ninth woman bodi for Dawn Park - timeline of discoveries and who dey behind dis killings?
Dis go make am di ninth deadibodi wey di police dey declare say dem don see in di last two months.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.















































