Nigeria demand answers as anoda citizen kpai for police custody for South Africa

Wia dis foto come from, Brenton Geach/Gallo Images via Getty Images
Nigeria dey demand for investigation and answers about di death of one of dia citizens, afta di Nigerian consulate claim say South African police officers arrest and torture am until e kpai for dia hand.
According to one statement by di Nigerian Consulate General for Johannesburg on Tuesday, di victim wey im name na Odueze Chimezie Odueze, kpai on 9 October for Parklands, Cape Town, for South Africa.
Di consulate tok say police bin arrest di victim for one shopping centre as dem suspect say e carry drugs, and dem follow am go im house to search am, but dem no see any drugs, den as dem dey torture am, e kpai.
Di circumstances of di death and di allegations against di police neva dey independently verified by di BBC.
Di consulate say di incident na "one too many" and dem call on South African authorities to investigate thoroughly and prosecute anyone wey dey responsible for di crime.
"No matter wetin di allegations fit be, e get processes and steps to justice," di statement tok.
"Evribodi suppose dey granted fair hearing for court of law and nobody suppose take laws into dia own hands."
Di statement also ask Nigerians for South Africa to remain calm, obey di law and dey alert to dia security, for di middle of concerns ova attacks and threats against foreign nationals.
'E suddenly start to vomit' - SA Police tok
Meanwhile, di South Africa police don release statement wia dem claim say, di victim bin just start to dey vomit suddenly afta police search am, and e die bifor dem fit give am any help.
"On 9 October 2026, at around 07h10, members of AGU (Anti-Gang Unit), Crime Intelligence, Metro K9 Unit and SANDF (South African National Defence Force), bin dey on joint operation wen dem receive information on one person of interest.
"Dem proceed go Wood Drive for Table View and pull ova one 49-year-old man, and dem inform am of warrant wey dem get to search im flat.
"Dem allegedly search im car, and dem no find anything, and dem proceed go im flat wia dem allegedly find drugs.
"E allegedly tell di members say e wan tok but im no trust police officers. Three SANDF members bin dey for di flat wit am wen he allegedly start to dey vomit.
"Dem transport am to hospital but dem declare am dead on arrival.
"Dem report di incident to IPID for investigations and investigations still dey go on."
Dis incident dey come at a time wen tensions dey veri high between Nigeria and South Africa ova di safety of Nigerians and allegations of abuse by South African security personnel.
For July, Nigeria bin condemn di death of two of dia citizens for separate incidents.
Emeka Charles Iroegbu bin allegedly kpai for di hands of di Tshwane Metro Police officers for Pretoria, while Musa Yunana Joe bin kpai after some jaguda pipo bin attack am for Witbank.
Nigeria don also call for investigations into oda deaths wey involve dia citizens and South African security personnel.
Dis latest case dey come on top plenty anti-immigrant protests and threats against foreign nationals wey don add to concerns about dia safety for South Africa.
Di Nigerian consulate tok say e go continue to press for di fair treatment of dia citizens, and e no go stop to dey insist say "Nigerian and all lives matter".
E also express condolences to Odueze family.





















