Judge kick out hospital request wey no want make dem crosscheck wetin kpai Chimamanda Adichie pikin

Chimamanda Adichie
Published
Read am in 3 mins

Lagos State High Court on Monday bin cancel Euracare Multi-Specialist Hospital application wey dey request to stop di coroner examination into di death of Chimamanda Adichie pikin, Nkanu Esege.

Di hospital bin argue say since dem cremate di deadibodi e mean say di coroner no fit really do di inquest and dat di order go against right to fair hearing.

But Justice Aishat Opesanwo troway di application say di inquest na wetin law make compulsory and say di bodi no necessary for di coroner decision to continue di inquiry.

Na afta Nkanu bin kpai on 7 January 2026 afta medical procedures na im dem begin investigate to know wetin kpai am.

Di hospital bin also tok against di coroner decision to collect statements and evidence from medical personnel and oda parties wey dey connected to wia dem treat di pikin bifor im kpai.

But di judge tok say, "di provision no allow room for exercise of discretion for di decision to do inquest once e land say death come from any of di nine situations".

For her ruling, Justice Opesanwo say under Section 15(2) of di Lagos State Coroner System Law 2007, e dey compulsory to do inquest wen death happun inside medical facilty.

She also torchlight say coroner court na to find wetin cause di death and no be criminal or civil trial to find who cause and put punishment on top.

Nigerian award winning author Chimamnda Adichie bin write about Nkanu back in June say e get emotional intelligence, dey funny and get ogbonge climbing skills.

Chimamanda say Nkanu, wey be di older twin and ”first son dey named afta dia grandfather, wey be obstetrician-gynecologist Dr. Nkanu Esege”.

Chimamanda remember ”one day last December“ wia her late son hear wen she dey complain about her knee pain afta workout.

Na so her pikin begin rub her mama knee, saying, "Mama, sorry."

"E go randomly get on di sofa and stand up and give me tight hug. If I say, "Kiss for Mama," e go immediately lean forward and present im lovely lips."

Chimamanda describe her late pikin as ”absolute Daddy Boy“ sake of say na only im papa e dey allow to put am to bed for night.

Di author say Nkanu love to dey sidon for floor wit her to look at picture books and also to play round di house wit im papa.

"E love to have im extended family togeda. If we all gada for di living room and one pesin get up to leave, Nkanu go cry. E wan chop evri adult food," di author describe im son.

Chimamanda say im late son get climbing skill as e dey jump ontop table and also try get ontop kitchen counter.

"E get sense of humour wey dey delightful. Im laughter dey lift spirits.

"We get two highchairs for di dining room, two car seats for di car, two toddler beds for di bedroom. And now only one toddler."