Pope Leo XIV get lung cancer, Vatican tok

Di Pope as e land for hospital, as security follow am and dozens of pipo stand behind barriers hold dia phone up to snap am
Wetin we call dis foto, Pope Leo land for Rome Gemelli Hospital ahead of im surgery on Tuesday
    • Author, Sarah Rainsford
    • Role, Southern and Eastern Europe correspondent
    • Reporting from, at the Gemelli Hospital, Rome
    • Author, Olivia Ireland
  • Published
  • Read am in 4 mins

Doctors don diagnose Pope Leo XIV wit lung cancer, but dem successful carry out di surgery to remove one lower lobe from im right lung, di Vatican tok for one medical bulletin.

Di 71-year-old bin undergo one 90 minute surgery on Tuesday for Rome Gemelli Hospital and dem later diagnose am wit lung adenocarcinoma.

"Afta di operation, di Pope wake up normally and return afta one brief period of observation to im room on di10th floor," di Vatican tok for statement.

Dem first detect di lump during wetin di Vatican describe as "routine checks".

Earlier, large crowds gada outside di hospital to greet di Pope, as some bin wait for several hours.

Dem shout dia greetings and well wishes as e pass by, while e wave and smile back through di lowered back window of im car.

Im staff meet am on di hospital steps. "I dey sorry," one of dem show sympathy, di Pope smile give and nod. "We dey hia for you," dem assure am.

For dia statement, di Vatican tok say dem remove di whole lower lobe of di Pope right lung "to ensure di procedure dey radical".

One Vatican source tell Agence France-Presse news agency say dem don carry out further tests to see if any sign dey to know if di cancer don spread.

Na Leo XIV imsef announce di tori of im operation give di world on Sunday, as e dey tok from di balcony for St Peter's Square afta e deliver di traditional Angelus blessing.

E say doctors don "contain" di nodule, or growth, wey dey im lung as dem find am "at a very early stage", but doctors advise am to remove am.

Gemelli thoracic surgery team bin operate on do Pope. Di team bin don already clear dia schedule until 20 October to give am time to recover.

Nodules dey quite common and no necessarily dey cancerous, but afta dem examine am, di medical team confam say na pulmonary adenocarcinoma, "as suspected by pre-operative tests", di Vatican tok.

Di Vatican don stress am say di pontiff, wey pipo generally believe say dey fit, no show symptoms of infection or illness.

The Pope delivering a speech from a windowsill on Sunday
Wetin we call dis foto, Pope Leo XIV announced the news of his operation during his weekly Sunday prayers in Rome

Cardinal Kikuchi Tarcisio Isao of Tokyo bin write on social media say im meet wit di Pope Leo on Monday, and e say di pontiff no feel "anytin wrong" physically.

E say di Pope bin decide to check in for surgery as soon as possible becos e suppose travel go Latin America for early November, and e dey hope to stick to di plan.

Di trip particularly dey important becos e include one visit to Peru, wia di pontiff bin serve as missionary and den as Bishop for many years.

Despite all di reassurances, di tori don shake all Catholics all ova di world.

"Am I worried? Yes, becos I really no dey expect anytin like dis," Vatican Secretary of State Cardinal Parolin tell tori pipo on Tuesday.

E say di news be like "bolt from di blue", but e say di cardinals dey shocked by di Pope "calmness" and dem dey confident say im go recover.

Outside Gemelli Hospital, wey don treat several popes and be home to one large statue of John Paul II, few Catholics remain for there afta dem admit di pontiff.

Carla don come specially, wanting to be close.

"E look so calm, so we dey calm too - even though sickness always na bad tin," she tell BBC. "We go wait hia and pray."