Wetin to know as former DR Congo President Joseph Kabila bicom leader of new rebel movement

Joseph Kabila former President of di Democratic Republic of Congo
Published
Read am in 4 mins

Di former President of di Democratic Republic of Congo, Joseph Kabila, don bicom di leader of one new political and military joinbodi movement, wey include di M23 rebels, and di aim, according to dia founders na to "liberate" di kontri.

Di Front for di Refoundation of di Nation (FRN) tok say dia aim na to coordinate "resistance forces" to end "tyranny" for di Democratic Republic of Congo and dem go pursue di goal "by all means, including force".

Dia unveiling on Monday na di clearest indication so far say Kabila get hand for di armed movement one year afta dem sentence am to death in absentia for treason. E bin don previously deny any connection M23 rebel group.

Di Congolese govment neva comment.

Wetin to know about di new movement

Dem announce di coalition for one press conference for Kabila residence for Goma, di largest city for eastern DR Congo, wey don dey under di control of di M23 since last year.

Dia mission na to coordinate "resistance forces" to make sure say dem end di "tyranny", and establish new political framework for di kontri., and dem go pursue dat mission "by all means, including force", di statement tok.

Founders of di movement also announce provisional leadership structure and dem unanimously appoint former President Kabila as head of di FRN pending di full establishment of di various institutions for di organisation.

Di announcement dey come just three days afta oga Kabila bin deliver ogbonge national broadcast wia e tok say witin di coming days and weeks, im go set out how Congolese pipo suppose act to "rescue" dia kontri.

Kabila tok for dat broadcast say di nation get "appointment wit history" and e accuse President Tshisekedi govment of disregarding di proposals wey im bin put forward for May 2025, including measures wey go end di crisis situation for di eastern region of DR Congo.

Di former president also accuse di govment say dem dey undermine constitutional rule, dey mismanage di economy and dem fail to improve security.

E further tok say di govment dey engage in arbitrary arrests of political opponents and military officers, but Tshisekedi administration neva publicly respond to di allegations.

Dis declaration on Monday na di clearest indication so far say former President Kabila dey directly involved for di armed movement wey dey oppose di govment for Kinshasa.

More dan 100 militia groups dey active for eastern DR Congo amid ethnic tensions and fighting for political power and control of lucrative natural resources.

Di authorities for Kinshasa neva comment on di creation of di FRN.

Who be Joseph Kabila?

Joseph Kabila wen e bicom DRC President at di age of 29 in 2001
Wetin we call dis foto, Joseph Kabila bicom DRC President for di age of 29 afta di assassination of im papa, Laurent Kabila

Joseph Kabila na di President of DR Congo for almost 18 years, from 2001 to January 2019, wen e step down and hand over power to Felix Tshisekedi afta election wey.

Di former president don remain largely out of public view but recentl e don increase im criticism of di administration of im successor.

Now 55, Kabila bicom President wen e dey 29 years old, afta im papa, Laurent Kabila bin dey assassinated.

Afta im tenure in 2019, Kabila continue to be a strong voice for DR Congo politics, and for December 2023, e go into self-imposed exile to South Africa.

In 2025, one DRC military court sentence Joseph Kabila to death in absentia sake of charges of treason, war crimes and crimes against humanity.

Di court rule say Kabila bin dey collaborate wit Rwanda and di M23 rebels to destabilise di kontri, even though e deny di charges dat time and describe am as politically motivated.

Earlier dis year, di United States of America also impose sanctions on Kabila sake of im alleged role in funding rebel groups.