How three sisters take dia own lives by drowning afta di death of dia mother

Wia dis foto come from, Sussex Police
- Author, Charlie Rose
- Role, South East home affairs correspondent
- Author, Zac Sherratt
- Role, South East
- Published
- Read am in 4 mins
Three sisters wey drown for one sea near Brighton take dia own lives, one coroner rule.
Jane Adetoro, 36, Christina Walters, 32, and Rebecca Walters, 31, bin dey live "very private lives" afta di death of dia mother, wey drown for 2010, senior coroner Penelope Schofield tok.
On 11 May, di women – wey all of dem dey live togeda for Greenford, London – visit one area for Birmingham close to wia dia mother die, bifor dem travel di next day go Brighton beach, wia dem later drown for rough seas conditions for di early hours of 13 May.
Di coroner tok say dem no sabi swim.
Dia father Joseph Jacobson say e dey heartbreaking to lose "all three of my precious daughters".
E dey among di family members wey follow di proceedings via video link.
E dey among di family members wey follow di proceedings via video link.
For inside one emotional statement e read out on im behalf, e say im watch im daughters grow from little girls to beautiful, intelligent women "wit special place for my heart".
E say: "Words no dey wey fit adequately express di pain of losing a child.
"To lose all three of my precious daughters na heartbreak wey pass anything I for ever don imagine."
E no fit understand why im daughters' lives end so suddenly, and e hope say dem don reunite wit dia mother "in God's eternal care", e add.
Wetin di coroner tok

Wia dis foto come from, Getty Images
Di coroner tell di court say: "These three sisters bin live very private lives, dem be very private pipo, we no know why dem take dis course of action or why dem choose to do am for Brighton.
"E no dey for di court to speculate and sadly these reasons fit no ever dey known."
Court hear say di sisters bin comot dia house for London and reach Brighton togeda by taxi at 22:21 BST on 12 May.
Di Uber driver tok say dem no follow each oda tok during di journey.
Di three sisters appear to dey waka up and down di beachfront for darkness, according to CCTV footage wey show dem for different places along Brighton East Beach.
Di last time anybody see dem alive na for 2:42am on 13 May, bifor dem later enta di sea.
Di CCTV recordings form part of di evidence wey di coroner examine during di inquest into dia deaths.
Police search Christina laptop and dem discover 227 references to water and 179 references to suicide.
Di coroner tok say Christina bin dey experience anxiety and depression since di death of her mother.
Rebecca medical records no show anytin and Jane no dey registered wit any doctor, Det Ch Insp Mark Cullimore tell di court.

Wetin happun to dia mother
One previous inquest into dia mother death show say her cause of death na drowning.
Postmortem tests reveal say toxicology results for all three sisters dey negative for drugs and alcohol. No evidence dey to suggest say dem dey face any kain violence.
One RNLI crew na im comot Ms Adetoro from di water and dem declare her dead for di scene on di morning of May 13, di inquest hear.
One RNLI lifeboat recover di body of Christina Walters, wey dey work for accountancy, from di sea.
Di body of Rebecca Walters, wey dey work for HR, bin float come di shore of Brighton beach.
Paramedics bin pronounce dem dead dat morning.

















