Wetin energy ceasefire Trump announce mean for Russia and Ukraine war

One composite image wey show Trump (left), Zelensky (middle) and Putin (right)
    • Author, Tinshui Yeung
  • Published
  • Read am in 4 mins

Donald Trump claim say Russia and Ukraine don agree to one emergency "energy ceasefire".

Kyiv tok say dem go support dat kain move but Moscow neva comment on am yet.

Di US president insist say e dey "effective immediately" but e no provide any details.

Ukrainian President Volodymyr Zelensky initially express surprise at di announcement, bifor Kyiv say dem go support am if Moscow also support am.

Zelensky also accuse Russia of striking Ukrainian energy facilities afta Trump post.

Trump don ask Ukraine to stop strikes on Russian oil infrastructure – wey Kyiv say dey important to reducing revenue for Moscow war machine - so Russia go fit fulfil one recently-struck deal to release diesel to di US and di global market.

Wetin we call dis Video, Watch: Wetin dey behind Trump energy ceasefire claim?

Di diesel deal wey go allow some Russian fuel imports enta market again don dey face plenty criticism. Zelensky bin call am gift give Russian President Vladimir Putin. European officials and some US politicians, wey include members of Donald Trump Republican Party, don tok say dem no support di arrangement.

Di deal na di latest move wey Donald Trump dey use try reduce fuel price for America before di midterm elections. For months now, im administration don dey battle wit di political effects of di war wit Iran, wey don push global fuel prices go up, especially diesel prices.

Dis don make many Americans vex wit Trump, as higher fuel prices for filling stations don affect plenty households. Di increase for fuel cost don also push prices of goods and services go up, and e don lead to broad inflation wey don put more pressure on consumers.

Zelensky support ceasefire, but say Russia must too

Thick black smoke spread for sky on top one industrial area
Wetin we call dis foto, Plenty smoke dey rise from di skies from di site wia diSlavneft-Yanos oil refinery for Russia dey located on 6 August

Zelensky confam say im support di energy ceasefire wey Donald Trump announce.

"Ukraine support di ceasefire, and e dey important make Russia support am too," Zelensky write for X.

E also tok say: "We dey wait for more details from di American side. For our side, Ukraine always dey fully support any step wey fit reduce tension, protect lives, and help end di war while securing lasting peace."

BBC don ask di White House for further details.

UK Prime Minister Andy Burnham say Britain "strongly support President Trump call today for a sustained energy ceasefire to start now", while France, Canada and di EU also express support.

Zelensky later tok say Russia attack one power plant for Kyiv wit drone, wey cause power cuts, followed by strikes on energy facilities for di north-eastern Kharkiv region.

"All of dis happun afta di president of di United States make im statement about one energy ceasefire," e tok.

Wetin di ceasefire fit mean for di warring countries

For months now, Ukraine and Russia don dey attack each oda energy infrastructure, including power facilities and oil installations.

Moscow maintain say di facilities wey dem target na legitimate military targets bicos dem dey support Ukraine military operations.

On im side, Zelensky don describe Ukrainian attacks deep inside Russia as part of efforts to "reduce Russia ability to finance di war."

Di attacks on both sides don cause serious damage to energy supplies and infrastructure, making energy facilities one of di major battlegrounds since di war begin.

Earlier on Sunday, UK Defence Secretary Wes Streeting tell BBC say UK no support am, while EU foreign policy chief Kaja Kallas voice Zelensky criticism of am on Saturday.

Di deal don also attract criticism from politicians of both main US parties.

Seven senators, including three Democrats and four Republicans, don release statement wey say Donald Trump diesel deal "dey go directly against" one law wey clearly ban Russian energy imports.

Dem tok say: "Congress don make am clear say America no suppose import oil from Russia until e stop im aggression against Ukraine and stop threats against our Nato allies."

Di senators come urge di Trump administration make dem reverse di decision.

One of di senators, Thom Tillis, wey be Republican, tell NBC News say di deal "absolutely go put American lives for risk."

Di criticism show say opposition to di deal no dey come only from Democrats, as some members of Trump own Republican Party also dey reject di move.

'Time don reach for Ukraine to get new president' - Trump

On Saturday, Donald Trump accuse Zelensky say e dey "cause problems for di world" by continuing to approve attacks on Russian oil refineries afta di Ukrainian leader criticise di diesel deal.

Di US president even suggest say "e don reach time for Ukraine to get new president."

But Zelensky respond by saying e go hold elections, even though Ukraine constitution suspend elections during wartime, if Russia agree to a 60-day total ceasefire.

Di Ukrainian president bifor now bin resist calls from US for fresh elections, as dem point to complications wey dey wit holding a vote for parts of di kontri wey dey active war zones or under Russian occupation.

Trump, however, don repeatedly accuse di Ukrainian leader say e dey use war to stay in power.

Meanwhile, strikes and fighting on di ground don continue for di four-year-long war.

Six pipo die for inside attacks on two Ukrainian cities on Sunday, regional officials tok

One pesin die for Russia Belgorod region, wey border Ukraine, while anoda man was die for inside drone attack for di Russian-occupied Donetsk region, officials tok.