Inec clear Rivers APC govnorship candidate, odas for 2027 elections

O.K Chinda wear white cloth with gold design button, e look inside di camera . E also wear cream colour hat wit black stripe design.
Wetin we call dis foto, Kingsley Chinda na former minority leader for di House of Representatives under di Peoples Democratic Party (PDP)
Published
Read am in 5 mins

Di All Progressives Congress (APC) govnorship candidate for di 2027 election for Rivers State don get clearance from di Independent National Electoral Commission (Inec).

Inec clear Kingsley Chinda for di 2027 govnorship election for Rivers State, south-south, Nigeria afta dem include im name for di list of govnorship candidates wey dem release on Saturday night.

Inec publish di names of govnorship candidates for all di political parties wey go contest for di 2027 elections.

Kingsley Ogundu Chinda na di former minority leader of di House of Representatives and na former member of di Peoples Democratic Party (PDP).

Im bin dey represent di Obio/Akpor Federal Constituency from 2011 t0 2019.

Kingsley Chinda name begin trend months ago wen im emerge as di govnorship candidate for di All Progressives Congress (APC) for Rivers State wen di public bin know am as member of di Peoples Democratic Party.

Nigerians begin ask question about wen im port join di APC and weda im still be minority leader for di House of Representatives.

Afta di Supreme Court judgement on Thursday 24 September, 2026 Kingsley Chinda name begin trend again as di Supreme Court judgement restore some provisions of di Electoral Act 2026.

Supreme Court rule on di Electoral Act 2026 provisions wey dey govern political party membership registers and di nomination of candidates.

Di seven-member panel wey Justice Adamu Jauro lead set aside di court of appeal judgement wey bin void sections 77(5), 77(6), 77(7) and 84(2) of di Act.

Dis sections concern di statutory requirements wey relate to political parties membership registers, direct primaries or consensus as methods for di nomination of candidates by political parties.

Sake of dis supreme court judgement, one group Association of Legislative Drafting and Advocacy Practitioners (ALDRAP) ask di Independent National Electoral Commission (Inec) to disqualify Kingsley Chinda as di APC govnorship candidate for Rivers state for di 2027 election.

Di group bin ask Inec to check "di status of di APC govnorship nomination, di applicable membership-register requirements, di records wey bin dey submitted to Inec by di APC, and di appropriate steps wey dey required to give effect to di Supreme Court decision".

Wit all dis tok-tok, di APC for Rivers State tok say 'We no get issues' as dem bin react to di defection of dia candidate Kingsley Chinda.

Wit dis list wey Inec release, e mean say im no get any issue and im go still be di govnorship candidate for APC for di 2027 election.

List of some govnorship candidates state by state

Abia State

Opah Eric Chinemeucheya - APC

Kalu Kalu Agwu - ADC

Ijioma Uchechukwu Charles - APGA

Otti Alex Chioma - LP

Ogah Iroetugo Ndubuisi - NDC

Anosike Kelechi - PDP

Akwa Ibom State

John James Akpanudohedehe - ADC

Eno Umoh Bassey - APC

Jimmy Stella Monday - APGA

Mbaba Michael Bush - LP

Enyong Michael Okon - NDC

Brownson Ibanga Akpan - PDP

Cross River

Otu Bassey Edet - APC

Obu Ogar Osim - LP

Archibong Arthur Javis - PDP

Joelyn Ita Hogan - Bassey - ADP

Delta State

Ogboru Ovedje Great - ADC

Oborevwori Sheriff - APC

James Esther - LP

Itovwaye Chris - NDC

Mrakpor Peter - PDP

Obuseh Felix Ogechukwu - SDP

Lagos State

Gbadebo Rhodes Vivour - ADC

Hamzat Kadri Obafemi - APC

Odunaike Oluwapemilerin Olurotimi - LP

Doherty Olufunsho Adeshina - NDC

Doherty Adedeji Olugbemiga - PDP

Olaniyi Olufemi - SDP

Enugu State

Ocho Bodoeze Chukwuma - ADC

Mbah Peter Ndubuisi - APC

Ugwu Okwudilichukwu Chukwudera - LP

Ohaa Chiyeaka Christian - NDC

Nnaji Uchechukwu Geoffrey - PDP

Iloka Friday - SDP

Rivers State

Pidomson Gabriel Baritulem - ADC

Kingsley Ogundu Chinda - APC

Boms Chima Ernest - LP

Lulu-Briggs Dumo Owukori - NDC

Ejekwu Samuel Soni - PDP

Ben-Gurion Peter - SDP

Ebonyi State

Ukpai Mbah Udeh - ADC

Nwifuru Ogbonna Francis - APC

Nwodom Lucy Chinwe - APGA

Eze Oko Spledour - LP

Igwe Nwagu Palinus - NDC

Chukwuma Odii Ifeanyi - PDP

Niger State

Mohammed Kpataugi - ADC

Mohammed Umaru Bago - APC

Mohammed Adamu - APGA

Mohammed Usman - LP

Muhammed Yahaya Adam - NDC

Muhammed Mamman Nami - PDP

Nasarawa State

Nuhu Angbazo- ADC

Christopher Mamman - ADP

Aliyu Ahmed Wadada - APC

Gaza Jonathan Gbefwi - LP

Emmanuel David Ombugado - PDP

Muhammed Abubakar Adamu - SDP

Oyo State

Adegoke Taofeek Adeboyega - ADC

Alli Sharafadeen Abiodun - APC

Salami Gbolagade Tajudeen - APGA

Kareem Thompson Sola - LP

Yusuf Akim Adebola - NDC

Gbolarumi Hazeem Ola - PDP

We dey update dis tori