Why court strike out Nigerian govment criminal charges against 'fake' agency DG Adeniyi Adeyemi

Wia dis foto come from, Prince Adeniyi Adeyemi/Instagram
Di Federal High Court for Abuja don strike out di eight count criminal charge wey di federal govment bring against di alleged fake Director General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC), Adeniyi Adeyemi.
Justice Mohammed Umar cancel di case afta di federal govment bin request for di cancellation.
Di reason be di federal govment don carry di case go di High Court of di Federal Capital Territory make dem run am from beginning.
On Monday, di lawyer for di prosecution Rotimi Oyedepo (SAN) bin move di application say make dem terminate di charges.
Oyedepo tell di judge say di Attorney General of di Federation and Minister of Justice (AGF) bin crosscheck di case file of Adeyemi and find out say di charge wey di Inspector General of Police file get k-leg inside.
Also e add say di documents wey Adeyemi bin allegedly forge na wetin di High Court for di FCT fit prosecute - no be wetin di Federal High Court fit prosecute.
Di Director of Public Prosecution of di Federation (DPPF) bin tok say dem don file new charges for di High Court of di FCT and say dem go sharp-sharp arraign Adeyemi from scratch.
Di application no face any objection from Adeyemi lawyer, Ibrahim Angulu (SAN).
Di difference between dis two courts na di two different laws wey shape dem as well as say one na federal court and di oda one na state court.
Dem dey try Adeyemi wit two odas wey dem no know wia dem dey on top charges wey include alleged conspiracy and forgery.
Nigerian govment bin first expose dis 'fake agency - PFIPC/PEAC' - wey Adeniyi Adeyemi be di Director General, and di Presidency tok say di agency no be lawful federal agency, even though dem dey operate from di Federal Secretariat, get official bank accounts and letters show say dem get approvals from di Head of di Civil Service of di Federation.
Adeyemi bin deny di allegations and insist say im appointment no be wayo. E claim say na di Chief of Staff to di President, Femi Gbajabiamila bin facilitate im appointment and sign im appointment letter.
Oga Gbajabiamila don since deny di claim and file court case against Adeyemi for libel.
However, police authorities say dia investigations reveal say Adeyemi represent imsef as di Director General of PFIPC and im run di operation alone.
Dem later charge Adeyemi to court bifor Justice Mohammed Umar of di Federal High Court for Abuja, wey order make police arrest am as e refuse to show for court.
For July, di House of Representatives form committee to investigate how PFIPC take get allocation of 1.302 billion naira for di 2026 budget, even wen dem no get any legal backing.
For one of di investigative hearing, di Head of di Civil Service of di Federation, Didi Esther Walson-Jack, take responsibility for approving recruitment for PEAC/PFIPC.
Walson-Jack admit say her office no try as dem fail to do di necessary background checks bifor giving critical approvals to di 'fake agency'.
"My office bin receive di letter of appointment and di establishment act, and based on dose documents and also based on interactions wit di representatives of di PEAC/PFIPC, dem go on to issue di authorised establishment, and later di recruitment waiver.
"As we don see all di fact and observe all di document, we concede say we suppose carry out more due diligence in di discharge of di duties of di office in issuing authorised establishment and recruitment waiver to di PEAC/PFIPC," Madam Walson-Jack tok.
Also, one director from di office of di Accountant General of di Federation, Joshua Luka, tell di House Committee say na one of im junior officers no do wetin e suppose do, as e allow Adeyemi to take one letter wey suppose dey forwarded to di office of di State House Permanent Secretary.
However, Adeyemi wey suppose also attend di hearing to tok im own side, no show face as di Inspector General of Police tok say di mata don already dey bifor court, and dem gatz need court order bifor dem go produce di suspect.
Las las, di House of Reps committee, wey dia Chairman na Yusuf Gagdi, lawmaker representing Kanke/Kanam/Pankshin Federal Constituency of Plateau State, reach conclusion say Adeyemi na di mastermind of di fraud and recommend im prosecution.
In response, Adeyemi lawyer, Festus Akhigbe tok say dem deny im client im right of fair hearing just bicos dem wan make a "scape goat".
Akhigbe point accusing fingers at oda govment agencies like di Central Bank of Nigeria, di Economic and Financial Crimes Commission, di office of di Secretary to di Govment of di Federation, and di office of di Head of Service, wey e claim say dem also dey complicit for di scandal.




















