Tinubu break silence on alleged fake agency, give ICPC marching order to investigate - five oda tins e tok

Tinubu wearing blue dress wit glass

Wia dis foto come from, Bola Tinubu/X

Published
Read am in 4 mins

Nigeria President Bola Tinubu don order anti-corruption agency to investigate di activities of one alleged 'Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC).

President Tinubu say make di Independent Corrupt Practices and Other Related Offences Commission (ICPC) conduct investigation into di activities of di alleged agency and all matters wey dey related to am.

"President direct say di investigation go dey concluded and comprehensive report go dey submitted to am within 30 days."

Dis na di first time wey President Tinubu go comment on dis matter.

According to Bayo Onanuga, di Special Adviser to di President on Information and Strategy, for im statement on Tuesday 7 July, 2026, say di federal govment neva establish dat kain office.

Tinubu order dey come afta controversy choke for di Presidency, as di office of di Chief of Staff to di President as well as di main tok-tok pesin for di President, Bayo Onanuga, disown one Prince Adeniyi Adeyemi wey claim to be appointee of di President.

Adeniyi Adeyemi, according to im claims, na di Director-General of di Presidential Foreign Intervention Promotion Council/Presidential Economic Advisory Council.

Howeva statement from Femi Gbajabiamila, di president Chief of Staff, tok say di Nigeria govment no get any office like dat and President Tinubu no eva give any appointment to oga Adeyemi.

But checks by BBC News Pidgin show say dis agency wey di presidency claim say e no exist, bin get allocation for di 2026 budget, and dem don hold high profile govment events wey no dey hidden.

Why Tinubu give investigation order into Presidential Foreign Intervention Promotion Council

According to Onanuga, di reason why president Tinubu order dis investigation na sake of di different claims wey allege say na di Nigeria govment create di Presidential Foreign Intervention Promotion Council (PFIPC).

Howeva, di federal govment don deny am say dem no know anytin about di PFIPC and e no get 'basis for any law, presidential instrument, executive approval, or oda lawful act of Govment.'

"One Adeniyi Adeyemi Matthew present imsef as di Director-General of di so-called PFIPC and falsely claim to be presidential appointee."

Di presidency say dem no sabi di so-called appointee.

President Tinubu say im govment no go allow impersonation or forgery for public service and dose wey dem catch go face di law.

"Di integrity of di Presidency and di institutions of di Federal Govment gatz dey protected against impersonation, forgery, abuse of official identity and di exploitation of weaknesses for di public service.

"Di President direct say all pesin wey dem find im hand for dis act go dey treated strictly in accordance wit applicable law."

Tinubu say make all ministries, departments and agencies of di Federal Govnment provide information wey go help di ICPC to complete dia investigation.

Oda issues Tinubu order ICPC to investigate about PFIPC

Oga Tinubu mention all di issues wey di anti-corruption agency ICPC go investigate for di matter.

Some of di matters wey Tinubu want make ICPC investigate include:

  • Di forged appointment letters and oda official govment documents;
  • Di use of false claim of presidential appointment to seek or obtain official recognition and diplomatic support, wey include visa facilitation;
  • Di opening of multiple bank accounts in di names of purported govment agencies using allegedly forged documents,
  • President Tinubu also direct di ICPC to investigate not only di conduct of di principal individual and oda collaborators involved but also di wider circumstances wey enable di fictitious body and false claim of presidential appointment to acquire appearance of official legitimacy,
  • Di investigation go examine di use of false official documents;
  • Di processes through which e don find official recognition or diplomatic support;
  • Di opening and operation of any related bank accounts;
  • Di source and movement of any funds involved;
  • Di role of any public officer, private individual, financial institution; intermediary or oda pesin or entity wey fit don facilitate, enable or participate for di alleged scheme.