Who be Emmanuel Nnorom wey dey replace Tony Elumelu as UBA chairman

Wia dis foto come from, @TonyOElumelu/X
Ogbonge African economist Tony Elumelu announce say im go step down as di Chairman of di United Bank of Africa (UBA) on 12 August, as di 12 years tenure wey di Central Bank of Nigeria prescribe for Non-Executive Directors of Banks go end.
Elumelu wey announce di informate on Monday, 7 July for statement tok say, im don conclude im 12-year-tenure as Chairman Group Board of UBA.
"As I close dis chapter for UBA, I do am wit excitement; for di future of UBA, for di future of Africapitalism, and for di limitless opportunities wey lie ahead for our continent," Elumelu tok.
Di veteran banker introduce Emmanuel N. Nnorom as di next Chairman of UBA.
"I welcome Emmanuel N. Nnorom as di next Chairman of Africa global bank, wey now dey serve 50M+ customers across 20 countries and 4 continents.
"I get full confidence for im leadership and I ask di public to give am di same trust and support una generously give me ova di years, e tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Who be Emmanuel Nnorom

Wia dis foto come from, Emmanuel Nnorom/LinkedIn
UBA describe di new Chairman as an accomplished business leader wit ova 40 years of experience for financial services, audit, and corporate governance.
E don serve for several executive and board-level capacities across leading organizations, and e bring ogbonge expertise in financial management, strategic leadership, and enterprise oversight.
E be Fellow of di Institute of Chartered Accountants of Nigeria (ICAN) and honorary member of di Chartered Institute of Bankers of Nigeria (CIBN).
Oga Nnorom dey recognized for im professionalism, integrity, and depth of industry knowledge. E be alumnus of Templeton College, Oxford, wia get further training for im executive leadership and management capabilities.
Wit proven record of excellence and stewardship for both financial and corporate governance spheres, Oga Nnorom continue to play a pivotal role in advancing strong business practices and sustainable growth across di organizations wia e dey serve.
Bifor dis new appointment, Emmanuel Nnorom na di current Group Chief Executive Officer for Heirs Holdings. According to im LinkedIn profile, e enta di post for June 2017.
Previously, e bin serve as di President/CEO of Transcorp Plc, wey dey oversee di Transcorp businesses. Bifor Transcorp, Emmanuel bin work as Executive Director and Managing Director for United Bank for Africa (UBA)
What next for Tony Elumelu
Elumelu, wey also be di founder of Tony Elumelu foundation, one ogbonge non profit organization wey dey champion entrepreneurship for Africa, and dey empower new generation of African entrepreneurs tok say, dis no be di end, but anoda chapter for lifelong commitment to build institutions wey go last long for Africa.
"As I close dis chapter for UBA, I do am wit excitement; for di future of UBA, for di future of Africapitalism, and for di limitless opportunities wey lie ahead for our continent.
"I continue my lifelong commitment to building enduring African institutions, advancing entrepreneurship, investing in businesses, and contributing to Africa economic transformation through im organizations," e add.










