Argentina come from behind to qualify for quarter-final afta dem beat Egypt 3 - 2 for World Cup 2026 Round of 16

Messi wit oda players for pitch wit crowd for back

Wia dis foto come from, Justin Setterfield/Getty Images

Published
Read am in 4 mins

Defending champions Argentina beat Egypt to qualify for di quarter-finals of di 2026 Fifa World Cup.

Argentina come from 2-0 down to lead Egypy afta Enzo Fernandez jump high and head di ball into di bottom left corner for injury time.

Di last goal na from wen Lautaro Martinez cross di ball from di left and Chelsea midfielder Enzo Fernandez dey dia for di back post chnace di header past Mostafa Shobeir.

Lionel Messi first level di score sheet for Argentina for di 83 miniutes to make up for di penalty wey im miss bifor afta Tottenham defender Romero pull one back for Argentina.

Argentina go now face Switzerland or Colombia for di quarter-final game.

For di 67 minutes, Mostafa Zico double di score for Egypt to put dem two goals ahead of di Argentine team.

Messi penalty wey e miss na part of di highlights of di match afta Egypt goalkeeper punch di ball comot.

Ogbonge 90 minutes of footbal wey pipo tink say e go enta extra time but Argentina say no way wit late goal.

Tears of joy from Argentina players, tears of sadness from di Egyptians.

Lionel Messi also cry becos im World Cup career dey just minutes away from ova, but en dem need am most, e show up wit assist for di first goal and score di equaliser.

Dis na one of di great World Cup comebacks wia Argentina fight through to di next stage of di tournament.

(L-R) Emiliano Martinez and Lionel Messi of Argentina and Mohamed Salah and Mohamed El Shenawy of Egypt ahead of di FIFA World Cup 2026 Round 16 match between Argentina and Egypt

Wia dis foto come from, FIFA VIA GETTY IMAGES

Argentina and Egypt face each oda for dis 2026 FIFA World Cup Round of 16 on Tuesday, July 7 2026, for Atlanta Stadium.

As many pipo bin expect, Argentina don qualify for di Round of 16 for di sixth straight World Cup. But e no easy for dem as many pipo bin tink.

For one of di most exciting World Cup matches ever, Argentina need extra time bifor dem fit beat Cape Verde, wey dey play dia first World Cup, for di Round of 32.

Wit dat win, Argentina don now win 11 straight matches, wey be dia longest winning run eva, and dem neva lose for dia last 10 World Cup matches, wey also match dia record.

La Albiceleste don score two or more goals for 10 straight World Cup matches, equal di second-longest run ever (West Germany from 1938-58) and just one match behind di longest record wey Uruguay set from 1930-54.

Wit di goal wey Lionel Messi score against Cape Verde, e don now score seven of Argentina 11 goals for dis World Cup, and di equaliser against Egypt make am eight goals.

Meanwhile, Egypt qualify for di World Cup knockout stage for di first time for dia history afta dem beat Australia 4-2 for penalty shootout following 1-1 draw, but dat hope don end again.