Who be Ozonna Soludo and why e dey trend?

Wia dis foto come from, Charles Soludo
Anambra state govnor Chukwuma Soludo first son Ozonna don go viral for social media.
Dis na sake of say e dance to one popular music wey collect major politicians for Nigeria including him papa and Nigeria president Bola Tinubu.
For di video wey e post for him Facebook page wey don get millions of views on Saturday Ozonna wear brown short and yellow top wey carry image of im papa dey dance to di music vibes.
One of di lines for di video say "Tinubu shame unto you".
Oda names wey dem mention inside di song include Nigeria Vice President Shettima and di senate president Godswill Akpabio plus former Rivers state govnor Nyesom Wike.
E also call out names of state govnors and popular rights activist Sheik Gumi.
Ozonna never come out to explain why e do di video abi why e call out di Nigeria politicians, but di young man dey popular for post dance videos on im personal social media handles.
For one of di old videos e show wear him dey dance wit him papa Chukwuma Soludo.
Di video don get over 11,000 comments and close to a million views on Facebook alone.
Ozonna wey don live most of him life abroad bin don talk say criticism no fit stop am or make am change who im be or how im dey.
For 2025 interview wit content creator Goodybag, Ozonna say him no go apologize to Nigerians say dem no like am, say im no dey leave him life to please any pesin, say im go kontinu to be imsef.
Who be Ozonna Soludo

Wia dis foto come from, OZONNA/ FACEBOOK
Ozonna na 32-yea-old son of govnor Soludo. Im be di first son of Govnor Chukwuma Soludo of Anambra state.
E get five siblings, but among dem, na Ozonna and im first sister Adaora popular pass. Adaora na fashion entrepreneur and politician.
Ozonna na graduate of Institute of Contemporary Music London.
Im be musician, songwriter, and content creator wey start to dey perform for small small venues around di city before e upgrade. E don live for both di US and di UK.
Some of im big songs dey titled "Big Flex" and "Take it slow".
E say e don dey make music since im reach 13 years.
E dey popular for di kain vibes im dey showcase for social media.
For some of im videos e dey tint im hair and sometimes dey wear artificial long hair.
Ozonna dey popular for social media, e get about 500k followers on Facebook, for TikTok e get about 100k followers wit over 2.9 million likes.









