'Our children no fit go school and we no fit comot for house' - Resident cry out ova Anambra communities kasala

Wia dis foto come from, BBC, Charles Chukwuma Soludo/Facebook
- Author, Tunde Ososanya
- Role, Senior Journalist
- Reporting from, Lagos
- Published
- Read am in 3 mins
Fresh kasala between Aguleri and Umuoba Anam communities for Anambra East Local Govment Area of Anambra State, southeast Nigeria wey don claim lives don trap many residents for house as fear dey rise.
Di kasala wey burst on Thursday, 1 October becos of land dispute between Aguleri and Umuoba Anam kpai and injure pipo.
One Aguleri resident wey follow BBC News Pidgin tok and wey no want make we mention her name say na becos of signpost wey Anam erect ontop di land wey dem dey fight ova cause di kasala.
"Anam bin comot Aguleri signpost comot for di land and leave dia own for dia sometime back. But Aguleri put back dia signboard recently and naso kasala burst and dem begin burn houses and evritin.
"Di pipo of Umuoba Anam kpai pipo immediately for dat spot. I bin dey shop and hear say dem don kpai eight pipo," she tok.
Di Aguleri resident say di pipo of Umuoba Anam burn down many schools and houses and even burn dia Igwe house.
Which land dem dey fight ova?
Di land wey di two communities dey fight ova dey around di boundary between Aguleri and Umuoba Anam for Anambra East Local Govment Area of Anambra State.
Di kasala na about wia di boundary between di two communities dey and who get di right to di land for di disputed areas.
Attempts bin don dey bifor by di state authorities and community leaders to resolve di disagreement through dialogue, instead of to allow di kasala to worsen.
Govnor Soludo call for peace, convene emergency meeting
Anambra State Govnor Chukwuma Soludo don directed Amaeze Aguleri and Umuoba Anam communities for Anambra East Local Govment Area to stop di kasala immediately and allow peace reign.
Inside one statement wey di Govnor Chief Press Secretary Christian Aburime release, Soludo express deep sadness sake of di pipo wey die and injure during di kasala.
E say violence, bloodshed and destruction of property no get place for Anambra state.
"Following recent reports of communal clash between Aguleri and Umuoba Anam for Anambra East Local Govment Area, which tragically result for di loss of life and injuries, di Govnor of Anambra State, Prof. Chukwuma Soludo, don intervene decisively to restore law and order," di statement tok.
Aburime say Govnor Soludo don convene emergency peace and security meeting wit key stakeholders from di affected communities to hold on Wednesday, 7 October 7, 2026, for di Light House.
"In di interim, di Governor don issue stern directive as e order both communities to immediately cease all forms of hostilities, maintain absolute peace, and exercise restraint.
"All grievances, claims, and presentations gatz di channelled exclusively through dia designated stakeholders for di upcoming Awka meeting.
"Furthermore, security agencies, including di Police, don dey fully deployed to di area to enforce law and order, safeguard lives, and prevent any further breach of di peace," di statement add.



















