Netanyahu say pilot chop arrest afta e stab co-pilot and try to crash plane wey dey go Israel

Benjamin Netanyahu and FlyDubai plane
Published
Read am in 4 mins

One pilot for one Israel-bound plane stab im co-pilot and "apparently try to crash di plane", Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu tok.

Di FlyDubai plane bin dey travel from Dubai to Tel Aviv wen e drop from 17,000ft (5,200m) in less dan two minutes, bifor dem divert am to Saudi Arabia.

One passenger report "terrible screams throughout di plane" bifor "three to five guys burst into di cockpit" and overpower di attacker.

Anoda passenger say "we take control of di flight" from "one assailant wit a knife" - meanwhile, two oda pilots, wey sit for back, reportedly come forward to land di plane.

Netanyahu say di pilot wey launch di attack don chop arrest. E "salute di heroes" wey "save many lives and prevent major disaster".

Di plane wey take off from Dubai International Airport early on Wednesday send emergency code about two hours afta di journey start, according to flight tracking website Flightradar24.

Few minutes later, di plane switch to code wey dem dey use report hijacking, but later return back to di general emergency signal.

Dem believe say di emergency signal come afta one "altercation" between di pilot and im co-pilot, according to local media reports wey quote Israeli defence officials.

Map show flight situation

'All passengers dey safe and accounted for'

Flight FZ1073 - wey carry about 150 pipo, most of dem Israelis bin suppose land for Ben-Gurion Airport but instead land for Tabuk Airport for northeastern Saudi Arabia.

Reports say di alarm happun afta one 'fight' between di pilot and di co-pilot.

One Israeli passenger wey dey onboard tell journalists say di crew ask for help and passengers later help overpower one of di pilots and tie am down.

For one statement, lsraeli Prime Minister Benjamin Netanyahu say di situation don dey under control and efforts dey go on to return di Israeli passengers from Saudi Arabia back home.

FlyDubai confam say di flight "experience one incident" but say "all passengers dey safe and accounted for".

"FlyDubai fit confam say flight FZ1073 wey dey operate from Dubai International (DXB) go Ben Gurion International Airport (TLV) on 30 September experience one incident while e dey on route.

"Di aircraft land safely for Tabuk Airport (TUU) and all passengers dey safe and accounted for. Di safety and well- being of our passengers and crew remain our highest priority.

"Our teams dey work closely wit di relevant authorities. We go provide further updates as more confirmed details bicom available," di statement tok.

Map show airlane movement

Yasmin Abu Kasis tell di news agency say im daughter Miriam bin dey onboard di flight and say she hear pipo dey scream.

Im daughter say one man wey hold knife force one of di pilots enta floor, and say blood dey evriwia.

One Israeli passenger wey dey onboard tell journalists say di crew ask for help, and say passengers help overpower one of di pilots and tie am down.

One passenger wey no mention im name tell di Jerusalem Post say one pilot stab anoda pilot, but passengers wey sit near di front of di plane help force di attacker comot from di cockpit.

Di witness say two oda pilots bin dey onboard for di back of di plane.

Di passenger also say one dentist wey dey onboard di flight give di injured pilot life-saving treatment.