'Nigeria don pass through red sea' - Key highlights of Tinubu Independence Day nation address

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X
Nigeria President Bola Tinubu don promise citizens of di kontri to look forward to a period of "shared and widespread prosperity" bicos di "emergency treatment" wey di economy bin dey go tru, don finish.
Dis na one of di ogbonge tins wey Tinubu tok for im national broadcast on Thursday morning to celebrate di kontri 66th Independence Day Celebration.
Like im former speeches, Tinubu start wit explaining why e be like say Nigerians dey pass tru difficult period, as e tok say leaders of di kontri, ova di years, bin no dey courageous enuf to take di hard decisions wey for make di kontri beta.
Nigeria be like cancer patient we suppose get serious but painful treatment, but instead of dat, e decide to be taking morphine to mask di pain while di cancer dey spread, Tinubu tok.
Here na some of di ogbonge tins wey Tinubu tok for im Independence Day speech:
'No going back to subsidy'
Tinubu criticise pipo wey e describe as "certain influential but regressive voices" wey wan carry Nigeria go back to di "abuse of addictive subsidies" and abandon di necessary treatment wey e dey take.
Dis fit be attack on former Vice President Atiku Abubakar, who dey also contest for president wit di African Democratic Congress (ADC) for di 2027 general election.
Atiku tok say e go restore petrol subsidy if e win di presidency so dat fuel go dey cheaper and di cost of living go fall.
"We must to resist dia siren song. We must remember why we began dis journey and how far we don already come," Tinubu tok.
'Our reforms dey work'
Presido Tinubu maintain say no be im administration cause di weakness for di Nigerian economy, instead e dey confront am and di result clearly show say di reforms dey work.
Tinubu tok say: "By 2023, poverty bin dey rise, and hope was nearly gone. Di kontri situation bin dey darker dan ever. We bin no get choice but to act.
"Three and a half years later, di evidence say Nigeria economic outlook don improve dey undeniable.
"Oil theft dey down. Inflation don fall substantially from its peak. Our foreign reserves don dey rebuilt, our foreign exchange market don stabilise, and in 2025 dis kontri bin record di highest revenue from non-oil exports for im history, wey pass $6 billion.
"Dis na real money wey real Nigerian businesses dey make".

Wia dis foto come from, Nigeria Presidency
'Ogbonge prosperity dey come'
Tinubu tok say im admission come into power, dia major work na to "correct our nation course. Now, our purpose dey simple: shared and widespread prosperity".
"Wen I speak of prosperity, I no dey tok just about larger economy, abstract numbers or better statistics. I mean something much more personal," Tinubu tok.
Di President explain say for dis period of prosperity, farmers go fit do dia work in safety, produce more food at cheaper price, and also earn well from dia work. Factories go get beta power supply, businesses go fit obtain credit and young pipo go find good work.
E continue: "... food and transportation go dey affordable, education go dey witin reach, and hard-working families go fit look towards di future wit confidence. Dis na di promise we must now fulfil."
Tinubu tok say im administration go bring down di cost of living by bringing down di cost of producing and moving goods around Nigeria.
'Pipo still dey suffer, but we dey address am'
Presido Tinubu tok say im know say millions of Nigeria still dey struggle to even chop food, or pay school fees, or pay hospital bill, or even transport moni to go to work.
However, e tok say dis struggles no start for di last three years of im administration but rada na consequence of many years of bad leadership wey fail many Nigerians.
"We no fit erase in four years wetin don accumulate ova generations. But we fit change di course. We fit build economy we go dey steady lift pipo out of poverty and make sure say dose wey remain vulnerable no go dey abandoned along di way," Tinubu promise.
Di President, like e also dey do for many of im past speeches, mention some of di policies wey im administration don put in place to try to support poor Nigerians, like di National Social Register, di Nigerian Education Loan Fund (Nelfund), di CREDICORP - to allow consumers borrow moni, among odas.
'Di promised land dey ahead of us'
"I believe deeply in wetin lie ahead," Tinubu tok, as e declare say im dey see di promised,
E say: "Di Promised Land bifor us na Nigeria of abundance and opportunity; a nation wia prosperity dey broadly shared, wia evri child fit dream beyond di circumstances of im birth, and wia our kontri immense promise go finally reflected for di life of our pipo.
"Our destination dey in sight. Our foundations dey strong. Our direction dey clear. So let us go forward. No looking back."



















