Wetin be Zamzam water and wia e come from?

Man drinking Zamzam water
Published
Read am in 4 mins

Many social media users from northern Nigeria dey for Mecca or Medina for Saudi Arabia to perform Umrah.

Many of dem, just as dem usually entertain dia followers on social media, also choose to make videos and fotos for Mecca or Medina, and one of di videos na about Zamzam, wey dey make many pipo ask questions about di water.

Dis prompt di BBC to investigate dis precious water and im importance to humanity.

Wia Zamzam Well dey?

Pipo dey fetch Zamzam water

Di Zamzam Well dey located inside di Haram Mosque for di city of Mecca, Saudi Arabia.

Di Grand Mosque na di largest mosque for di world, and na home to di Kaaba.

Large quantities of Zamzam water dey transported daily to di city of Medina to ensure di constant supply for di Prophet Muhammad mosque.

Millions of pipo consider Zamzam water to be holy water wey dem believe say fit cure diseases.

Visiting di mosque na part of di Hajj pilgrimage wey Muslims dey perform, and dem dey usually fetch water to take home to share wit relatives and friends.

Millions of pipo from all ova di world dey perform Hajj and Umrah evri year.

Belief be say Zamzam water get special power as di well no dey dry.

Drinking Zamzam water no dey compulsory but na sunnah, wey mean say na teaching of di Prophet Muhammad, and pilgrims dey usually drink Zamzam water afta dem complete di circumambulation and afta dem complete di di sa'i.

Pilgrims fit also drink water anytime dem need am, as water dey provided for evri location for di mosques of Mecca and Medina, as well as for hotels for di cities, for di drinking of Hajj or Umrah pilgrims.

Why Zamzam dey important to Muslims

Pipo dey fetch and drink Zamzam Water

Zamzam water dey important becos of im religious history.

According to Islamic belief, God bin create di well of Zamzam thousands of years ago wen e answer di prayer of Prophet Abraham wife - Hagar - wen e leave her and her son stranded for di desert, witout food or water.

Di explanation for dis dey inside Quran, for Surah Ibrahim, and further explanation dey inside many religious books.

Inside di hadith of Sahih al-Bukhari, dem explain say Hagar dey waka about as she dey search for water, ascending and descending two mountains, Safa and Marwa, until di angel Gabriel strike di ground wit im heel, wia water begin to rush out.

As she fear say di water go finish, Hagar kon repeatedly dey say 'zam-zam' in Arabic, wey mean say di water don stop to dey flow and e no go finish, and dis na wia di name Zamzam come from.

Shey fake Zamzam Water dey?

Blue tanks

Dem dey give pilgrims Zamzam water wen dem complete dia pilgrimage to Mecca.

Visitors also dey encouraged to take Zamzam home wit dem, but Saudi authorities no allow say make dem dey sell am.

Despite dis action by di authorities, reports of illegal sales of Zamzam dey for di UK.

For May 2011, one BBC investigation uncova how pipo dey sell non-Zamzam water inside plastic bottles wey dem label wit di name Zamzam, and dis prompt Saudi Arabia to tighten dia controls to ensure di supply of authentic Zamzam water.

Di Saudi Geological Survey, wey dey monitor di quality of Zamzam water, say dem dey pump am from di well through underground pipes for distribution to distribution points, wia tens of thousands of litres of water dey pumped out.

For 2017, di Saudi Food Safety Authority say dem destroy thousands of bottles of fake Zamzam water and close down some water purification facilities during one nationwide raid.