Police share update ontop woman wey allegedly use sex toys on daughter for livestream video

Wia dis foto come from, Anulika Onyeanusia/TikTok
Anambra state police command say dem don conclude investigation ontop di 36-year-old, Anulika Onyeanusia wey allegedly use sex toys on her daughter.
For statement wey di police tok-tok pesin, SP Ikenga Tochukwu sign, e say di Command don forward di case file to di Director of Public Prosecutions (DPP) for necessary legal action.
For middle of September 2026, Anambra police command bin arrest di woman afta video of wia she dey allegedly use sex toys on her daughter trend for online.
Di police command arrest Anulika and her husband for Onitsha, Anambra State on Thursday, 10 September.
Police tok-tok pesin for Anambra tell BBC News Pidgin say dem arrest di woman from her residence afta dem discover di video wey dey trend online.
Wen dem arrest her, Ikenga tok say di woman no make any claim say di content na AI content video instead she confess say she dey use sex toy on her daughter during di live video.
Police tok dat time say dem go charge di woman to court as soon as dem complete dia investigation and determine di crime wey di woman commit.
Update on di woman wey allegedly use toy on her pikin
On Thursday 24 September, 2026, Anambra police say dem don investigate di matta and dia findings dey inside file wey dem forward give di di director of public prosecution.
"Di Command also wish to provide update on di widely circulated video wey involve 36-year-old woman, wey we allegedly see dey engage in inappropriate sexual conduct involving her child"
"D Command don investigate di case and forward di case file to di Director of Public Prosecutions (DPP) for necessary legal action," Anambra police tok tok pesin say.
E add say di "suspect still currently dey for police custody,' until dem finish all di proceedings ontop her matta.
Di police say dem dey committed to protect children and oda vulnerable pesins from sexual abuse, exploitation, violence and oda forms of harm and go ensure say victims and survivors dey treated wit dignity.
Wetin happun bifor
Anambra state police inside dia statement on 11 September 2026, tok say dem don arrest Anulika on Thursday evening, based on wetin dem gada from social media ova one "disturbing trending video of one lady wey dey allegedly use sex toys on her minor."
Ikenga tok say dem rescue four pikin between di ages of two-nine from di woman and her husband, and dem recover sex toys and oda sexual related items wey dey relevant to dia investigation.
Ikenga add say dem arrest di woman husband too as e get some kwesions to ansa.
"Di operation also lead to di rescue of four children, age 2, 3, 6 and 9 years respectively, as well as di recovery of sex toys and oda items wey dey relevant to di ongoing investigation.
"Di suspect currently dey for police custody as di command dey intensify dia investigation into di circumstances wey dey surround di alleged offences and di possible involvement of oda pipo wey fit dey involve.
"Di husband of di suspect also dey undergo interrogation to determine weda e get any connection wit di alleged offence," Ikenga explain.
Anambra state commissioner of police, Nnanna Oji describe di action as "unacceptable becos e involve di exploitation and abuse of children wey no fit protect demsefs."
E say make police carry out thorough and professional investigation while dem ensure say di rescued children get appropriate care and protection.
Ikenga don promise say di command go work wit appropriate child-protection and relevant support agencies to ensure say di victim receive di necessary care, protection, counselling and oda support wey she require for her recovery.
"We go protect dia identities and privacy throughout di process, and we go treat dem wit compassion and sensitivity," di statement tok.
"Di command also commend di vigilante operatives for di area, as well as bloggers and residents wey provide information during di investigation wey lead to di arrest of di suspect."



















