Why EFCC neva act on Nigerians calls to prosecute Blessing CEO sake of stage 4 cancer claim and donations

Blessing CEO

Wia dis foto come from, @officialbblessingceo/Instagram

    • Author, Tunde Ososanya
    • Role, Senior Journalist
    • Reporting from, Lagos
  • Read am in 4 mins

Several Nigerians don call on di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to prosecute influencer and relationship expert Blessing CEO ontop accuse say she make false claim say she get stage 4 cancer and receive monetary donations from Nigerians.

According to di influencer, Nigerians bin donate 13 million naira for her afta she come out to solicit funds.

Wen di video of her stage 4 cancer claim go viral, some Nigerians no believe am and dem request say make she post her medical results on social media, while some express pity for her alleged condition.

For one viral interview wit internet personality Egungun of Lagos, Blessing CEO say na miscommunication happun wey make am believe say she get stage 4 cancer.

"I neva start chemo - I just get di result - dem dey call am biopsy. Na lump. Initially dem say e no dey cancerous, afta few months wen I bin wan take out di lump, dem kon tok say e dey cancerous," she tok.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Di BBC no dey responsible for di content of external sites.

End of X post

BBC News Pidgin reach out to di EFCC tok-tok pesin Dele Oyewale but e decline comment on di mata.

However, one authoritative source from di anti-graft agency wey tok to BBC News Pidgin on di condition say we no go mention im name say di EFCC neva receive any petition from di public to prosecute di influencer apart from di social media tags wey dem dey see.

"As an organisation, weneva mata like dis come up, we no dey work on social media agitation, frenzy and all of dat. We always want make pesin place petition bifor us wey we fit work on.

"Independently, we fit do our own intelligence, but certainly we no dey always go by social media frenzy, agitation and all of dat.

"If we arrest am, which information we go place bifor di court if we need to prosecute am? We be veri organised agency," di source tell BBC News Pidgin.

Who be Blessing CEO?

Blessing Nkiruka, wey pipo sabi as Blessing CEO na influencer and relationship expert. Dem born am for Onicha Local Govment Area of Ebonyi State.

Netizens sabi her for her bold and controversial advice on relationships, love, and sex on social media platforms.

Blessing na 37 years old woman and she marry her first husband at di age of 18 for 2010 and dem born two children.

But she later divorce her husband at di age of 21.

She tok say she endure three years of serious domestic violence for her marriage.

For April 2019, Blessing CEO bin post fotos say she don build mansion for Enugu as single mama but di real owner, businessman Onye Eze, expose di lie and arrest her.

She later make video to apologise publicly say no be she get di property.

Blessing CEO also dey entangled in di relationship controversy between Ikechukwu Darlington Ogbonna popularly known as IVD and im wife.

Afta IVD wife Bimbo die for October 2022, e no too tey wey Blessing and IVD begin date. E later propose to am.