US announce new visa restriction policy for pipo wey dey engage in birth tourism and odas

Donald Trump sido dey look front

Wia dis foto come from, Chip Somodevilla/Getty Images

Published
Read am in 3 mins

US govment don announce new visa restriction policy for foreign citizens wey intentionally travel to di kontri just to born pikin, so dia pikin go be US citizen.

Di Secretary of State Marco Rubio wey announce di informate on Wednesday 23 September, tok say di policy visa restriction go also affect pipo wey dey facilitate birth tourism for di kontri.

"Dis visa restriction policy dey pursuant to Section 212(a)(3)(C) of di Immigration and Nationality Act. Certain family members fit also fall under dis restrictions," Rubio tok for statement.

For June, di Department of States tok say US embassies discova several operations wey allegedly dey use fake documents plus visa "fixers" to help foreign nationals get visa to born for di kontri and secure American citizenship for dia children.

Di department say one US embassy for West Africa bin uncova one network wey involve more dan 100 foreign nationals wey allegedly use fake documents and visa fixers to get US citizenship for dia children.

However, for di latest informate on di mata of birth tourism, di US say di new visa restriction policy go also touch:

  • Owners, operators and managers of commercial birth tourism
  • Visa fixers wey dey coach applicant to commit fraud
  • Foreign medical providers wey knowingly dey abet and facilitate such travel
  • and oda individuals wey dey support, abet, and enable commercial birth tourism

Di US govment say di reason why dem dey restrict di visa of dos wey dey engage for dis kain tin and dey benefit from dis "fraud", na to send clear message say: "United States no go allow foreigners to exploit our immigration system and violate di sanctity of U.S. citizenship."

Bifor dis latest measure, di Donald Trump administration bin earlier don establish task force to end birth tourism for di kontri.