Police discover di deadi body of anoda woman for South Africa

Wia dis foto come from, Getty Images
South African police don discover di deadi body of anoda woman for outside di Mooifontein Cemetery for di Vusimuzi informal settlement for Tembisa, Ekurhuleni.
Dis latest discovery on Saturday, 26 September don leave many residents in fear of dia safety.
E also bring to 10, di number of women dem find dia deadi bodies for di area since July.
Police for one short post on X tok say; "We discover one woman body for Tembisa South, for di Vusimusi section dis morning," dem no provide further details.
"At dis stage, we fit only confam di discovery of di body. Crime scene management and all di necessary role players currently dey di scene," police add for di post.
Police no give much details on di 10th woman, but e follow di death of nine oda women wey dem find dia bodies across Ekurhuleni, one major urban area of Johannesburg.
Di police no tok if dis body get any link wit di ones wey dem don discover bifor, dem also no provide any informate on who she be, dem however say, investigation dey go on.
Dem find dis 10th body for Tembisa south. Tembisa, na one large township wey dey di north of Kempton Park on di East Rand of Gauteng province. Di same area dem discover di previous bodies.
Most of di women wey dem find bin dey partially clothed and dem get injuries, but police make am clear say dem no fit establish weda na serial killer dey responsible for all di deaths.
Di discovery don spark fear for di area, particularly among women wey say dem no feel safe any longer.
"We dey fear to come out of our houses. We dey fear to go to di shops. We no dey free for di kontri wia we suppose dey safe as women," local resident Bongeka Sebela tell BBC.
Deputy police chief Lt Gen Tebello Mosikili as e dey follow tori pipo tok say "one team of analysts dey work hard to see if connection dey to all these cases" but di killing of Ntimba "be like say na murder wey come from relationship... dis include... a possible love triangle".
Police charge two wit murder in connection to di ninth victim
Meanwhile, police for South Africa bin arrest three suspects in connection wit one of di murder cases dem dey investigate for di Eastern part of Johannesburg.
Di police for statement on Monday, 21 September announce say dem arrest one man and two women dem suspect say get hand for di death of di ninth woman wey dem find her bodi for Dawn Park.
Dem charge di two women wit premeditated murder and say dem defeat di end of justice.
Dem release di man wey dem arrest wit dem witout charge.
Victims of di killings for Ekurhuleni in order of dia discoveries
- First victim - Busisiwe Mahlangu - dem find her for Kempton Park on 15 July 2026
- Second victim - Itumeleng Kekana - dem find her for Kempton Park on 3 August 2026
- Third victim - Nomfesane Mjobo - dem find her for Kempton Park on 26 August 2026
- Fourth victim - Unknown bodi - dem find her floating for Clayville river for Olifantsfontain on 7 September 2026
- Fifth victim - Gracious Nkomo - dem find her for Kempton Park on 10 September 2026
- Sixth victim - Elizabeth Moselakgomo - dem find her for Kempton park on 12 September 2026
- Seventh victim - Name withheld - dem no fit reveal her name yet until dem inform her family. Dem find her for Olifantsfontein on 14 September 2026
- Eighth victim - Dineo Motapane - dem find her for Kwa-Thema on 15 September 2026
- Ninth victim - Jabulile Ntimba - dem find her for Dawn Park on 17 September 2026
- Tenth victim: Unknown
South Africa get one of di highest rates of gender-based violence for di world. E also get a very high murder rate and though officials statistics no identify di gender of di victims, one recent estimate from di Human Rights Commission show say, on average, dem murder six women evri day between April and June dis year.
Di recent grim discoveries don spark national outcry on top di scale of di problem and e don increase di feeling of insecurity for many women.
President Cyril Ramaphosa don strongly condemn di abuse, rape and killing of women for di kontri.
E say women get right to waka for di streets of dia kontri at any time witout fear.
"Di abuse, rape and killing of women no be our heritage. E no get any culture worthy of di name wey go dey diminish di dignity of women," Ramaphosa tok.
Di South African President tok say na national shame say women for di kontri dey go tru so much pain and suffering.
E say violence against women no go be di inheritance wey dem go leave for di next generation.




















