Wetin law tok about Blessing CEO stage 4 cancer claim and donations as Nigerians call on EFCC to prosecute her

Wia dis foto come from, @officialbblessingceo/Instagram
- Author, Tunde Ososanya
- Role, Senior Journalist
- Reporting from, Lagos
- Read am in 4 mins
Nigerians on social media dey para and dey call on di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) to prosecute influencer Blessing Nkiruka wey pipo sabi as Blessing CEO.
Dia vex and call for Blessing CEO prosecution na sake of di stage 4 cancer claim wey she bin make and di donations wey Nigerians make for am wey reach 13 million naira.
Wen di video of her stage 4 cancer claim go viral, some Nigerians no believe am and dem request say make she post her medical results on social media, while some express pity for her alleged condition.
For one viral interview wit internet personality Egungun of Lagos, Blessing CEO say na miscommunication happun wey make am believe say she get stage 4 cancer.
"I neva start chemo - I just get di result - dem dey call am biopsy. Na lump. Initially dem say e no dey cancerous, afta few months wen I bin wan take out di lump, dem kon tok say e dey cancerous," she tok.
Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of Instagram post
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Wetin Nigerian laws tok?
For Nigeria, section 419 of di kontri criminal code tok say "any pesin wey by any false pretence, and wit plan to defraud, obtain from any oda pesin anytin wey dey capable for pesin to tiff, or make any oda pesin to deliver to any pesin anytin wey dey capable for pesin to tiff, dey guilty of felony, and fit go prison for three years".
Section 1 of Advance Fee Fraud and Other Fraud Related Offences Act, 2006, say anyone wey use lie deceive pipo to give dem money, property, or any form of benefit don commit criminal offence.
Dis law apply weda di pesin collect di money directly or simply influences odas to give di money to anoda pesin. Wetin mata be say di pesin intentionally create false impression to make pipo act in a way dem otherwise no go act.
Di law also make am clear say di offence no dey limited to straightforward cash transactions.
Another key point be say di law apply regardless of location – weda di pesin wey dem deceive dey Nigeria or abroad.
E no also mata if di transaction dey presented as contract, donation, or agreement. As long as the consent dey obtained through lie, di law treat am as fraud.
Anyone wey dem find guilty face a prison sentence of between 7 and 20 years, wit no option of a fine, and dis one make am one of di serious fraud-related offences under Nigerian law.
Who be Blessing CEO?
Blessing Nkiruka, wey pipo sabi as Blessing CEO na influencer and relationship expert. Dem born am for Onicha Local Govment Area of Ebonyi State.
Netizens sabi her for her bold and controversial advice on relationships, love, and sex on social media platforms.
Blessing na 37 years old woman and she marry her first husband at di age of 18 for 2010 and dem born two children.
But she later divorce her husband at di age of 21.
She tok say she endure three years of serious domestic violence for her marriage.
For April 2019, Blessing CEO bin post fotos say she don build mansion for Enugu as single mama but di real owner, businessman Onye Eze, expose di lie and arrest her.
She later make video to apologise publicly say no be she get di property.
Blessing CEO also dey entangled in di relationship controversy between Ikechukwu Darlington Ogbonna popularly known as IVD and im wife.
Afta IVD wife Bimbo die for October 2022, e no too tey wey Blessing and IVD begin date. E later propose to am.









