You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Wat next for ADC?
Nigeria opposition party African Democratic Congress (ADC) don challenge di decision of di Independent National Electoral Commission (Inec) say dem go go ahead to hold dia Congress.
ADC say dem don plan and schedule how dia Congress go take waka despite say Inec dey derecognise di acting National Working Committee of di party, ahead of di 2027 election.
Dis dey come afta di ADC reject di decision of Inec to remove di names of dia National Chairman David Mark, National Secretary, Rafiu Aregbesola plus names of oda National Working Committee members comot dia portal sake of one court of Appeal Court ruling wey neva settle.
Inec announce on 1 April 2026 say dem no go receive any 'further communication or deal wit any of di parties or groups on issues wey concern di affairs of di party.'
Inec come add say dem no go monitor any meeting, congress or convention on wey any of di two parties fo on behalf of di African Democratic Congress (ADC) 'until di Federal High Court decide on di matter.'
Na dis come make di ADC stakeholders gada for press conference. Di stakeholders include former Vice President Atiku Abubakar, former Senate President David Mark, Rotimi Amaechi of Rivers State, Peter Obi of Anambra State, Rauf Aregbesola of Osun State, plus Senator Rabiu Kwankwaso of Kano.
During di press conference wey David Mark lead, e tok say dem go kontinue wit dia congress and convention even if Inec no dey present to monitor am.
David Mark add say notin dey di Nigeria Constitution or electoral act wey make am compulsory for Inec to attend dia congress and convention bifor e fit dey acceptable.
David Mark even challenge President Bola Tinubu of di All Progressives Congress (APC) say why e dey fear.
As dis gbege dey go on, ADC tell dia members say wetin be dia next action na to hold dia congress and convention becos dem don notify Inec bifor now.
"Dis na to notify all party members say, despite Inec illegal actions, di African Democratic Congress go kontinue wit dia congresses as scheduled, having duly notified INEC by our letters dated 27th February 2026 and 28th March 2026," according to wetin ADC tok tok pesin, Bolaji Abdullahi, send give di public.
Wetin Inec 2027 timetable tok and wat next for ADC?
Di big kwesion now be say wetin go come happun to ADC as e remain few months to di 2027 general elections..
According to di new electoral act wey President Tinubu sign into law on 18 February, 2026 afta di National Assembly pass am, dem adjust di date for di conduct of election.
Inec bin first release di timetable for 2027 election, but later change am afta di President sign di ne electoral act.
According to di revised timetable, political parties go now conduct dia primaries between April 23 and May 30, and resolve all disputes wey fit come up within dat time.
Inec come set election campaigns for presidential and National Assembly elections to start for August 19, 2026, while campaigns for govnorship and state House of Assembly go begin on September 9, 2026.
Wit dis schedule political parties don dey do dia congress and conventions- including ADC wey release di timetable for dia own activities.
According to di tok tok pesin for ADC, Bolaji Abdullahi, e say despite di action of Inec not to monitor activities of di party congress and convention until di court cases end, dem go go ahead.
Since all political parties get till 30 May, 2026, to do all dia electoral preparations including primaries, if di court no take any decision ontop di ADC case, e fit affect dem ahead of 2027 presidential election and govnorship - starting wit Ekiti and Osun.
According to one Inec regulations for di conduct of Political Party primaries, dem make am clear say Inec officials gatz monitor any primaries.
"Di primaries of political parties gatz hold for di presence of officials of di Commission wey go determine say truly, di primaries hold in compliance wit di provisions of di Nigerian Constitution, di Electoral Act 2010 (as amended) and dis regulation."
If Inec come decide say dem no go attend ADC congress, convention and also primaries, wetin go happun? Either dia candidate name no go dey ballot box, or di matter drag go court again.
ADC congress and convention timetable
Election joinbodi for Nigeria Inec announce say di presidential and National Assembly elections go now hold on January 16, 2027, while di govnorship and state House of Assembly elections go now hold on February 6, 2026.
On dat basis, ADC release di timetable of how dia own congress and convention go take waka.
ADC through dia tok tok pesin tok say dem don alreadi notify Inec of di schedule and notin fit stop dem.
- Screening of aspirants- 7 April 2026
- Appeals on screening exercise -8 April 2026
- Polling unit, ward, and local govment Congresses - 9 April 2026
- Appeals on di Congresses-10 April 2026
- State Congresses-11 April 2026
- Appeals on di State Congresses- 12 April 2026
- Convention-14 April 2026