You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Trump replace US attorney general Pam Bondi
US president Donald Trump Don comot Pam Bondi as im Attorney general, BBC US news partner CBS report.
Deputy Attorney General Todd Blanche go now work as acting attorney general, while di Trump administration go give Bondi new role, CBS tok.
Trump bin confam di tori for Truth Social wia e post say Bodi dey go work "new job for di private sector", and say di person wey go replace her na her Deputy Todd Blanche.
E tok say, "Pam Bondi na ogbonge American patriot and loyal friend wey don faithful ly serve as Attorney General ova di last year. Pam don do ogbonge job to over see di big crack down in crime across di kontri as nursery don reduce to dia lowest level since 1900.
"We love Pam and she go transition to a much needed and important new job for di private sector wey go dey announced for future date and our Deputy Attorney General and very talented and respectful legal mind, Todd Blanche go step in as Acting Attorney General."
Di tin be say even though dis move bin no dey surprising, e bin dey soon.
Dis na as Pam Bondi bin dey by Trump as e become di first sitting president to attend Supreme Court arguments.
Pictures bin comot from di White House wey show di two of dem togeda.
Deputy US Attorney General Todd Blanche bin write for social media say e dey "grateful for her leadership and friendship" minutes afta Trump announce di mata.
E write for X say, "Pam Bondi lead dis department wit strength and conviction. We go Kontinu to back di blue, enforce di law and doing everitin for our power to keep America safe."
Who be Pam Bondi?
Dem born Pam Bondi for Tampa, Florida and she study criminal justice for di University of Florida for 1987 bifor she go do professional degree from Stetson University College of Law three years later.
She bin dey admitted to di Florida Bar for 1991.
Bifor she enta politics, 60 year old Bondi bin work as prosecutors for di Hillsborough county state attorney’s office wia she try cases "from domestic violence to capital murder". Dis na according to her lighting firm website wey profile am.
She bin dey elected as di first female attorney general for Florida in 2010.
Bifor she turn Attorney General, Bondi bin dey linked to di America First Policy Institute, a conservative think tank wey former Trump staff members start, wia she bin lead di legal arm.
She bin also serve for di Trump opioid and drug abuse commission.
Bondi wey be Trump paddy for long bin dey part of im legal team during im first impeachment trial and wen e make fake claims say voters fraud tiff di 2020 election comot im hand .