Key takeaways from Trump primetime speech on Iran war as Tehran cut warning give US

Read am in 5 mins

US President Donald Trump on Wednesday tok say di military don nearly accomplish dia goals for Iran and insist say di US fit end di war even if dem no open di Strait of Hormuz.

Di 20-minute speech from di Cross Hall for White House na di first since di war start. Trump bin try clear di confusion about im govment justifications regarding Iran but e no tok wen di war go end.

Trump prime-time address no be di war-don-ova declaration of victory speech wey evrione dey expect.

"I fit tok say tonight say we dey on track to complete all America military objectives shortly, veri shortly," Trump tok.

"We go hit dem extremely hard for di next two to three weeks. We go take dem go back to stone age wia dem belong."

Iran nuclear 'na intolerable threat'

Trump tok say dis speech go explain why Epic Fury dey "necessary for di America safety" and di whole world.

E list terrorist attacks and oda act wey Iran or dia proxies don do for di past 47 years, e call di regime wey dey run di kontri "thuggish and murderous" - e also point to recent crackdown on protest for di kontri wey kill thousands of citizens.

Leaders like dis no suppose get nuclear weapon, e tok.

"I no go let dat one happun."

Trump tok say Iran no gree give up on dia nuclear programme and dem dey develop di long-range missiles fast.

Dem dey 'right at di doorstep' to create nuclear weapon," e tok.

Trump tok say e dey honour to terminate di nuclear deal wit Iran.

Di US presido call di nuclear deal wey former US president Barak Obama negotiate mistake, and e say e dey honoured to terminate am.

Trump later tok about di strike wey e order for June 2025, wey dem call Operation Midnight Hammer, against Iran nuclear programme.

"Nobodi don eva see anytin like dis," e tok.

"We totally obliterate di nuclear sites."

US strategic objectives for Iran 'dey close to completion'

Trump tok say di US dey "systematically dismantle di regime ability to threaten America or project power outside dia borders".

E tok say dem don destroy Iran navy, air force and di missile production capabilities.

"Tonight I dey pleased to tok say dis our core strategic objectives dey near completion," e tok.

E tok say e don travel go Dover Air Force base to honour di 13 American soldiers wey die for di war. "We dey salute dem and now we gatz honour dem by completting di mission."

Trump urge kontris wey dey rely on Gulf oil make dem step in

Trump tok say US and Venezuela get oil production and add say US no need oil from abroad.

E say kontri wey need oil from Middle East go need to take charge to keep Strait of Hormuz open.

Energy shipment from Gulf don almost stop since Iran retaliate against di US-Israeli strikes by threatening to attack ships wey wan cross di Strait of Hormuz - wey be important trade waterway.

Trump tok say: "To di kontris wey no fit get fuel, many of dem no wan join for Iran decapitation... build up some courage, go to di Strait and just take am. Protect am."

Trump dey call for kontris make dem buy US oil instead.

Trump call war 'real investment' for future

Trump tok say US dey unstoppable as military force. E tok say di war na "true investment" for American pikin dem and future generation.

E also tok about di length of wars for 20th and 21st century. E tok say dem dey last for years but dis conflict don go on for only 32 days.

Trump tok say Americans no dey fear Iranian aggression again and "di spectre of nuclear blackmail" and add say di US go dey "safer, stronger, and more prosperous" pass how e don eva dey.

US and Israel attack dey 'insignificant' and warn of broader response - Iran react

Iran on Thursday cut warning give US say dem go carry out "broader" and "crushing" attacks in response to Trump latest threat to hit Iran "extremely hard" ova di coming weeks.

Tok-tok pesin for di Iranian military tok say di US and Israel don dey strike 'insignificant' targets.

Inside statement wey IRGC-affiliated Tasnim news agency and semi-official Fars news agency release, e tok say di two kontris get 'incomplete' information about Tehran military capabilities and equipment.

Di tok-tok pesin for di Iran military production tok say e dey take place for places wey "una no sabi at all" - as e reject Trump claims say Iran weapons stock don finish.

E tok say US and Israel "go pay for di aggression wey una start".