Tinubu ministers, appointees wey don resign to pursue political ambition

Read am in 5 mins

Three members of President Bola Tinubu cabinet don resign from dia office, according to di directive wey di president bin give make any appointee wey get political ambition ahead of 2027 election tender dia resignation on or bifor March 31.

Di three pipo wey don turn in dia resignation so far na di Minister of Foreign Affairs Yusuf Tuggar, Minister of State for Humanitarian Affairs Yusuf Sununu, and di Minister of Transportation Saidu Alkali.

Oda appointees of di president for different sectors don also tender dia resignation as at Monday, 30 March, 2026.

So who and who don resign?

Saidu Alkali

Saidu Alkali, don tender im resignation on Tuesday as im reveal im ambition to contest for Gombe State govnorship election.

Inside di statement wey im post for X on Tuesday, e tok say e wan contest for Gombe State govnorship poll for di forthcoming general elections.

Alkali dey try take ova from di current Govnor Inuwa Yahaya, wey im tenure go end for May 2027.

Di former minister of transportation tank di president for di chance to serve under im govment and di progress wey di transportation sector don make during im tenure.

"Di Minister of Transportation, Senator Said Ahmed Alkali don officially tender im resignation to di Presidency. Dis one follow di presidential directive wey require all political appointees wey wan run for elective offices to step down from dia current positions," tok-tok pesin of di ministry of transportation, Umar Alkali Jibril tok.

"Di Minister dey resign to contest for di govnorship in di upcoming elections. For im letter, e express deep gratitude to di president for di chance to serve, tok say beta progress don dey for di transportation sector during im tenure."

Alkali serve as first time senator for Gombe North for 2011, and im bin serve as three-time senator for 2011, 2015 and 2019.

Bifor im join di Senate, e bin serve as Special Assistant to di govnor of Gombe State from 2003 to 2007, and later as Special Adviser to di govnor from 2007 to 2008. Alkali also serve as commissioner of information from 2008 to 2009.

Yusuf Tuggar

Yusuf Tuggar for im resignation letter on Monday make am clear say di reason na bicos e wan contest for di govnorship election of Bauchi State.

Kimiebi Ebienfa, di tok-tok pesin for di Foreign Affairs Ministry, as well as Alkasim Abdulkadir, di tok-tok pesin for di Minister both confam di development to tori pipo.

"Di minister dey interested and e dey aspire to run for di govnorship seat of Bauchi State," Abdulkadir tok for im statement late on Monday.

Di Foreign Affairs Ministry say Tuggar bin make plenty achievements for im tenure as minister, including di evacuation of Nigerians wey dey face trouble for abroad, di development of ogbonge database for Nigerians wey dey for diaspora, plus diplomatic interventions to secure di release of Nigerians wey dem detain for foreign kontris.

Dem born oga Yusuf Tuggar for 1967 and e come from Gamawa Local Govment Area of Bauchi State. Im papa, Abubakar Tuggar bin represent Gamawa Federal Constituency for di House of Representatives for di Second Republic.

Tuggar get bachelor's degree for international relations from di United States International University, and e also get master's degree from Cambridge University.

Bifor im appointment as Foreign Affairs Minister, Tuggar bin don represent Gamawa for di House of Reps between 2007 and 2011, and e also work as Nigeria Ambassador to Germany from 2017 to 2023.

E don run two times for di govnorship seat of Bauch State but e no win am, now e wan try im luck di third time.

Yusuf Sununu

Oga Sununu come from Ngaski Local Govment Area of Kebbi State, and na medical doctor by training from di University of Maiduguri. E specialise for Obstetrics and Gynaecology.

Afta many years for medical practice, Sununu resign for 2019 as di Chief Consultant Special Grade 1 for di Federal Medical Centre, Birnin Kebbi, to join partisan politics.

E contest and win di House of Reps seat for Ngaski/Shanga/Yauri Federal Constituency of Kebbi State for 2019 and win am again for 2023 bifor Presido Tinubu appoint am as Minister.

For di House of Reps, Sununu bin also work as Chairman of di House Committee on Healthcare Services.

Tinubu bin first appoint am as Minister of State for Education bifor e later redeploy am to Humanitarian Services.

Oda appointees wey resign

Oda political nominees of di President don also dey tender dia resignation. Some of dem na:

Nasiru Gawuna: Chairman of di Governing Board of di Federal Mortgage Bank of Nigeria, wey bin don also run for govnorship for Kano State under di ruling All Progressives Congress (APC).

But tori be say Gawuna dey plan to comot from di APC and join di opposition joinbodi party, di African Democratic Congress (ADC), following di former Kano State Govnor Rabiu Musa Kwankwaso defection to ADC on Monday.

Anoda pesin na Abdulrazak Namdas from Adamawa State, wey Tinubu bin appoint as member of di governing board member of di Niger Delta Development Commission representing di North-East Zone.

Namdas tok say im resignation na sake of say e wan contest elective position for 2027.

Namdas don serve for di House of Reps for many years and even contest for di position of Speaker of di House for 2019, but e later step down dat time for Femi Gbajabiamila - di current Chief of Staff to President Tinubu.

Tori tok say e fit be say Namdas wan contest for di govnor of Adamawa State.