You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
BBC News, Pidgin - Home
Top Tori
Tinubu ministers, appointees wey don resign to pursue political ambition
Presideo Bola Tinubu bin give im ministers and oda appointees until di end of March to resign if dem wan pursue elected political office.
Trump tell UK and oda kontris to go collect dia own oil' from Strait of Hormuz
Di Strait of Hormuz na one of di world most important shipping routes, and dia most important oil transit choke point.
US Supreme Court go hear Trump birthright citizenship case - wetin be di laws for oda part of di world?
Di US dey give automatic citizenship to anybody wey dem born for dia kontri, but dis no be wetin dey happun evriwia globally.
'Nigerians no get any interest to destabilise South Africa' - Nigeria
Nigerians for South Africa dey obey laws for oda kontri and dem no get any interest to destabilize dia kontri.
Peter Obi/Kwankwaso ticket 2027? Former Kano govnor join ADC
Political sabi pipo say Kwankwaso joining di ADC na beta boost for di joinbodi opposition movement ahead of di 2027 general election.
IRGC Navy confam killing of dia commander Alireza Tangsiri and anoda pesin wey close di Strait of Hormuz
Dis news dey come inside one tori of possible US operation to seize one of di Iranian islands.
Outcome of PDP national convention wey Wike faction hold as Mohammed, Anyanwu emerge as chairman, secretary
One group of Nigeria opposition Peoples Democratic Party (PDP) wey di Minister of di Federal Capital Territory, Nyesom Wike, dey support don elect Abdulrahman Mohammed and Samuel Anyanwu as substantive National Chairman and National Secretary of di party.
Yemen Houthis join di Iran war wit attacks on Israel, as US Marines land di region
Yemen internationally recognised goment don call out wetin dem say na Iran regular move to drag di kontri enta di kasala.
Tinubu address light matter, oda tins wey happun for APC convention
From 20 govnors afta 2023 elections, di APC now command 31 out of di 36 states for Nigeria going into di 2027 polls.
Special Tori
Lagos State extend tax returns filing deadline - how to file individual tax returns
LIRS make di informate on Monday 30 March for one press statement wey di Head of dia Corporate Communications, Monsurat Amasa-Oyelude, sign.
South Africa dey consider to reduce fuel levy sake of Iran war, official tok
South Africa dey adjust fuel prices monthly and dey use formula wey dey factor in movements in global crude oil prices, di exchange rate and local taxes such as di fuel levy.
Wetin we know about Plateau deadly attack as govment impose 48 hours curfew
Di Commissioner for Information and Communication, Rt Hon Joyce Lohya Ramnap, say di govment condemn di "barbaric and unprovoked attack on innocent citizens".
Why US dey eye Iran Kharg Island?
Di tiny island na home to one of di most critical pieces of Iran energy infrastructure.
Wetin di 'No Kings' protest against Trump dey about?
Thousands on Saturday bin waka for street wit signs and plethora of high-profile Democrats wey go on stage for outside of di State Capitol building for St Paul.
Man die afta community flog am over alleged abuse of 10-year old girl
Tori be say di Ekowe community get tradition to flog pipo wey thief or rape pesin as a way to discourage odas.
Women wey dem secretly feem, den mock and abuse online
Women for Kenya and Ghana tell di BBC about di approach by one Russian man wey later posts dia videos without dia consent.
Oil and shipping: Africa get way out as crisis continue for Strait of Hormuz?
Iran war don reshape oil prices and shipping, squeezing Nigeria and Egypt but opening new routes through South Africa.
BBC News Pidgin now dey on Whatsapp
No dull yoursef, be di first to get latest tori, analysis, exclusive interviews and ogbonge coverage of Nigerian and International news from BBC News Pidgin, straight to your Whatsapp.