Burkina Faso gatz 'forget' about democracy, military leader Ibrahim Traore tok

Read am in 4 mins

Democracy "dey kill" and di pipo of Burkina Faso gatz "forget" am, di kontri military ruler tok for one interview wey air on state television.

Capt Ibrahim Traoré, wey seize power through coup three years ago, suggest say most Africans no want democracy system and say Burkina Faso get dia own alternative approach, but e no give details.

Traoré bin initially promise to restore democratic rule to di West African kontri by July 2024, but two months bifor di deadline, di junta announce say im go extend im rule for anoda five years.

For January, e ban all political parties as part of one plan to "rebuild di state".

For di interview wey hold on Thursday night, Traoré say: "Pipo need to forget about di issue of democracy. Democracy no be for us.

"Look Libya, dat na example wey dey close to us," di 38-year-old, wey carry imsef as revolutionary leader wey dey stand up to Western imperialism tok.

Libya dey ruled autocratically for four decades by Colonel Muammar Gaddafi, wey oversee one brutal regime, but e also dey provide Libyans wit subsided housing, free education and free healthcare.

Dem kill am during one rebellion wey Western military intervention support. Di north African since den don fail to hold elections and e dey divided between two rival administrations, along wit numerous armed groups.

"Wherever dem [Western powers] try to establish democracy for di world, bloodshed dey always follow," Traoré tok for im interview.

While some military takeovers don happun in recent years, most African kontris dey still hold regular elections, even if accuse full ground say dem dey rig am in favour of incumbents.

Two military leaders - for Gabon and Guinea - don organise elections wey be say na dem still win.

Traoré also tok about di dissolution of political parties. E say e see dem to be divisive, dangerous and no dey compatible wit di revolutionary protect.

"Di truth be say politics for Africa - or at least wetin we don experience for Burkina – na say real politician na pesin wey embody evri vice: pesin wey be liar, sycophant, and a smooth-talker," e tok.

Di junta leader no propose any alternative system, but e say: "We get our own approach. We no dey try copy anoda pesin. We dey hia to completely change di way tins dey occur."

E highlight building a new system wey dey rooted in sovereignty, patriotism and revolutionary mobilisation, wit traditional leaders and grassroots structures playing a central role.

For one wide-ranging interview, e also emphasise di importance of economic and military self-reliance, plus hard work, e say working six or eight-hour days no go allow Burkina Faso catch up wit richer kontris.

Traoré don silence dissent during im rule - e crack down on di opposition, media and civil society groups.

Im govment even chop accuse say e dey punish critics by sending dem to di front-lines of di war against Islamist militants.

Despite dis, Traoré don gain huge following across di continent for im pan-Africanist vision and criticism of Western influence.

Burkina Faso, like dia junta-led neighbours Mali and Niger, don move away from working wit Western kontris, especially France, for dia fight against Islamist militants, wey don create a decade-long insurgency for di region.

All dis three kontris don turn towards Russia for military assistance, but di violence still continue and e still dey ginger.

On Thursday, one report by Human Rights Watch (HRW) tok say more dan 1,800 civilians don die for Burkina Faso since Traoré seize power for 2023.

Di publication attribute two-thirds of di killings to di military plus allied militias, and dem blame di rest on Islamist militants.