Gunmen attack primary, secondary schools for Oyo and Borno states di same day, kpai teacher, abduct students, principal

Wia dis foto come from, Getty Images
Gunmen on Friday attack LA School and Community Grammar School, Ahoro-Esinele, for Ogbomoso, Oyo State, southwest Nigeria.
Di attacks happun on Tuesday, 15 May, wia di gunmen kpai one teacher, kidnap di principal, and abduct unspecified number of students for di attack.
Di Oyo State Police Command tok-tok pesin, DSP Ayanlade Olayinka, confam di incident.
DSP Ayanlade for one statement say di kidnappers storm di school between 8am and 9am.
"Gunmen enta Ahoro-Esinele area, Oriire Local Govment Area, Oyo State. Dem abduct one school principal and unknown number of students, e tok.
Oyo State close all primary schools for neighbouring communities
Oyo State Universal Basic Education Board (Oyosubeb) confam di incidents for one statement wey dem release on Friday.
Di Board don direct all primary schools for neighbouring communities, including Surulere, Oyo East, Oriire, and Olorunsogo, to immediately vacate dia schools until further notice.
According to Oyosubeb, dis na temporary measure to prevent any secondary incidents and to allow security agencies to thoroughly stabilise di area.
"Di Oyo State Universal Basic Education Board, OYOSUBEB, express profound sorrow and deep concern ova di unfortunate attack on LA School, Ahoro-Esinele, and Community Grammar School, Ahoro-Esinele, Oriire LGUBEA, wey bin result in di killing of one teacher and di kidnapping of some pupils.
"Dis na dark and painful moment for our education family for Oyo State, and our hearts dey wit di affected parents, teachers, and di entire community," di statement tok.
Dem say di accurate number of pupils wey di gunmen kidnap neva dey sure as security agencies continue to "comb di affected areas and establish full details of di incident".
"A tactical response team don dey deployed, and all necessary intelligence and operational measures dey go on to ensure di safe rescue of di pupils and to restore peace to di community."
Di Board assure parents say dia children no go dey abandoned, as dem add say di govment no go rest until evri child dey safely returned.
According to di Board, dem dey in constant communication wit security agencies, and updates go come out as new information emerge.
"At dis trying time, make we stand togeda as one united community. We mourn wit di families of di teacher wey im life dey tragically cut short.
"Im service, dedication, and sacrifice no go dey forgotten," di statement add.
Gunmen attack primary and secondary for Borno State
Meanwhile, Police for Nigeria north-eastern Borno State say armed men bin attack one primary school and one secondary school for Mussa village, for Askira-Uba Local Govment Area, on Friday morning.
Police tok-tok pesin Nahum Daso tell di BBC say di attackers arrived at about 09:00 local time. Authorities suspect di gunmen na ighters from either Boko Haram or dia rival faction, di Islamic State West Africa Province (Iswap) - both of dem dey active for di region.
Local reports for Borno State say several pupils and students bin dey abducted afta gunmen bin attack two schools on Friday morning.
One resident, Bukar Buba, tell di BBC say di attackers storm Central Primary School, Mussa and Government Secondary School, Mussa, for Askira-Uba Local Govment Area.
Buba say di daughter bin dey among dose wey dem take.
Police say many children remain unaccounted for, but authorities believe some fit don run into nearby bushes during di attack.
"We no get confirmation say di students bin dey abducted but confirmation wey we get be say many of di students run inside di bush during di time of di invasion," police tok-tok pesin Nahum Daso tell di BBC.
But Buba dispute di account, and wey say armed men on motorcycles take dozens of afta police patrol leave di area.
"Immediately afta dem leave, e no dey up to thirty minutes afta - dose attackers come to our community.
"Dem take almost 43 pupils, most of dem dey between di ages of 3 to 6."
E say some older students, believed to be around 15 years old, bin dey abducted.
Buba say residents watch from one nearby mountain as di attackers take di pupils on motorcycles.
"We no fit count di number of motorcycles but dem come wit many motorcycles."
E add say security forces don increase dia presence for di area and bin dey carry out search operations.









