'We wey dey alive, na God keep us' - Sojas wey survive Boko Haram attack for Borno tok afta Gen Braimah death

Brigadier General - Oseni Braimah

Wia dis foto come from, DHQ

Read am in 5 mins

Details still dey come out about how Boko haram terrorists attack one army base for Borno State, northeast Nigeria on Thursday, 9 April, 2026.

Di attack lead to di death of sojas for di Nigeria army, including one big oga wey im rank na Brigadier General - Oseni Braimah.

Videos wey dey circulate for social media show how some sojas wey survive di attack dey tok about wetin dia eyes see and how dia camp don dey destroyed.

"See my camp o," one of di soja wey dey film di video tok from behind di camera. "We wey dey alive na God keep us. RIP to di sojas wey loss dia lives. Kai! No be small tin (dis) army work."

E neva dey clear di exactly number of Nigeria Army personnel wey die for Thursday attack wey happun for dia base for Benisheikh, for Borno State.

Di army just release a statement wia dem tok say sojas of Operation Hadi Kai successfuly repel boko haram attack for Benisheikh on Thursday, but "di encounter bin result in di loss of a few brave and gallant soldiers who pay di supreme price for di line of duty".

"In line wit established military tradition and respect for di fallen, di general public and media are kindly requested to allow di Armed Forces to formally notify di next of kin before di release of further details," di statement by di Nigeria Defence toktok pesin Michael Onoja, a Major General, tok.

However, na late on Thursday evening President Bola Tinubu also release statement wia e praise di courage of di sojas wey kpai, and na for dat statement Presido specifically mention say Brigadier General Oseni Braimoh wey lead di counterattack on Thursday, also kpai.

"Di govment no go ever forget dia sacrifices. Dia sacrifices no go be in vain. Bicos of di courage and dedication of our troops for di frontline, our resolve to defeat terrorism and all forms of violence across Nigeria dey stronger dan eva," Tinubu tok.

One community leader for Benisheikh, Zanna Lawan Ajimi, also confirm to di BBC say Nigeria sojas kill plenty of di terrorists for di attack.

"We confam dat from military sources and members of our civilian JTF wey also fight back di insurgents during di attack. One civilian also die, and one sustain injury," Ajimi tok.

Also, former Nigeria Vice President Abubakar Atiku, share message for social media wia e send condolence to di family of Genreal Braimah and di oda sojas wey kpai for Thursday attack.

Atiku, for dat statement, also tok say di Imam of di 29 Task Force Brigade folo die for di attack.

"We honour dia supreme sacrifice and di daily sacrifices of all di brave men and women wey dey stand for di frontlines to keep our nation safe," Atiku tok.

Borno State na di epicentre for di insurgency and terrorism wahala wey Nigeria don dey face since more dan 15 years ago, and even though di Nigeria govment don dey tok say dem don almost clear di terrosists, attacks continue dey hapun for various parts of di State and di entire northeast region.

Sometimes sef, di terrorists dey also carry out attack for di major cities like Maiduguri di Borno State capital, wia suicide bombing attack kpai more dan 20 pipo for March dis year.

Di insurgency don kpai thousands of pipo for not just Borno State, but also neighbouring states like Yobe and Adamawa. Millions of civilians don also dey displaced from dia homes and now dey live for Internally Displaced Peoples (IDP) camps for across di region.

As e be now, no be only boko haram be di terrorist group wey dey operate for Nigeria northern region. E get di Islamic State for di West African Province (Iswap), and Ansaru wey be breakout faction from Boko Haram.

How pipo dey react

Meanwhile many pipo don dey react to dis recent attack wey kpai Brig Gen Braimah and oda sojas on Thursday.

Mohammed Bello El-Rufai, a member of di Nigeria House of Representatives and son of former Kaduna State govnor Nasir El-Rufai, describe di deaths as "inexcusable".

"Di death of Brigadier General Oseni Braimah and odas na collective shame on all of us wey get di responsibility to protect di lives of our pipo. As long as insecurity continue to increase, evri oda tin we dey do no go lead to our progress as a prosperous nation," e tok for im statement on X.

Popular broadcaster wey get di same surname as di army officer wey kpai, Rufai Oseni, post special tribute for im social media handle as e tok say: "General Braimah. True Hero. Mighty man of valor. E pay di supreme sacrifice. Nigeria dey wail. A black patch for our green flag. Nigeria go rise again. We no go ever forget."

One X user wey im user name na 'Naija Archangel' tok say "no serious nation dey. lose dia Brigadier Generals even for war times. For society wey dey work, dem suppose don declare State of Emergency. Oh Lord send us help."

Top army officers wey don kpai for terrorists hand

Some officers of di Nigeria army wey don die for di anti-terrorism fight

Wia dis foto come from, Nigeria Army

Di death of General Oseni Braimah go make am di third Brigadier General we go die for di hands of terrorist for Nigeria.

E follow di death of anoda Brigadier General, Sani Uba, wey die for Iswap ambush less dan five months ago.

Di Iswap terrorists wey murder General Uba first make video wia dem capture am, bifor dem later kpai am.

Here na some officers of di Nigeria army wey don lose dia lives for di fight against terrorism and insurgency for Nigeria:

Brig. Gen. Oseni Braimah - April 2026

Brig. Gen. Sani Uba - November 2025

Brig. Gen. Dzarma Zirkusu - November 2021

Lt. Col. S.I. Iliyasu - March 2026

Lt. Col. Umar Farouq - March 2026

Lt. Col. Aliyu Saidu Paiko - October 2025

Col. Dahiru Chiroma Bako - September 2020

Lt. Col. Ibrahim Sakaba - November 2018

Col. Muhammad Abu Ali - November 2016