Trump don land for Supreme Court ova birthright citizenship mata

Wia dis foto come from, Kent Nishimura / AFP via Getty Images
Di United States Supreme Court dey hear oral arguments on weda pikin wey dem born for US get constitutional right to citizenship.
Donald Trump don already break record as di first sitting president for America wey go attend oral arguments for di chamber even as na im start di gbege wit di executive order wey im bin sign for im first day back for office.
Di order bin wan enta automatic US citizeship wey dem bin dey give pikin dem wey dem born for di US by parents wey bin dey di kontri illegally abi dem just land di kontri for short time.
Di pipo wey bin dey against di Trump order say e go against di 14th Amendment of di US Constitution, wey dem ratify for 1868, wey tok say "all pipo wey dey born or naturalised for di United States, and dey subject to di jurisdiction be citizens of di United States".
Di pipo wey like di order say Trump new meaning of di clause go allow make govment fit fight "significant threats to national security and public safety".
Birthright citizenship worldwide
Birthright citizenship, or jus soli (right of di soil), no be di norm globally.
Di US na one of about 30 kontris - mostly for di Americas - wey dey give automatic citizenship to anybody wey dem born for dia borders. Oda examples na Brazil, Argentina, Chile, and Mexico.
In contrast, many kontris for Asia, Europe, and some parts of Africa dey follow jus sanguinis (right of blood) principle, wia pikin dey inherit nationality from dia parents, no mata di place wia dem born dem.
For example, Russia, Indonesia, Japan, China, Thailand, Vietnam, Nigeria, and most of di Middle East and North Africa dey use dis system.
India too dey follow jus sanguinis, while Pakistan na rare exception for Asia, dem dey grant automatic citizenship to anybody wey dem born for dia soil.
Oda kontris get combination of both principles, dem dey also grant citizenship to pikin of permanent residents. Nations wey dey use mixed approach include di UK, Portugal, Spain, France, Germany, Australia, and South Africa.
John Skrentny, sociology professor for University of California, San Diego believe say, though birthright citizenship or jus soli dey common throughtout di Americas, "each nation-state get im own unique road to am".
"For example, some involve slaves and former slaves, some no involve dem. History dey complicated," e tok. For di US, dem adopt di 14th Amendment to address di legal status of freed slaves.
However, Mr Skrentny argue say wetin most of dem get in common na "building a nation-state from former colony".
"Dem gatz dey strategic about who dem go include and who dem go exclude, and how to make di nation-state dey governable," e explain. "For many, birthright citizenship dey based on di territory wia dem born di pesin, e fit help dem achieve dia state-building goals.
"For some, e dey encourage immigration from Europe; for odas, e ensure say indigenous populations and former slaves, and dia pikin dem, go dey included as full members, and dem no go dey stateless. Dis na particular strategy for particular time, and dat time fit don pass. "









