300 Ghanaians wey govment evacuate from South Africa ova xenophobia dey expected to arrive today

Ghanais expected first batch of 300 evacuees

Wia dis foto come from, GHANA HIGH COMMISSION IN SOUTH AFRICA

Wetin we call dis foto, Ghana High Commissioner to South Africa dey brief Ghanaians for Cpae Town about di latest developments and xenophobia and wetin di Ghana govment dey do about dem
Published
Read am in 5 mins

Three hundred (300) Ghanaians wey register for voluntary repatriation from South Africa ova harassment and xenophobia dey expected to arrive for di kontri today.

Dis be afta embassy authorities and di Ghana foreign ministry conclude processes to bring back di citizens as anti-immigration protests dey continue for South Africa.

Since early April, foreigners for di kontri dey face harassment and threats from vigilantes and anti-immigration groups.

One of di groups March and March bin accuse do foreigners say dem collect dia jobs wey dem dey involved for crime.

Dem say all foreigners gatz comot dia kontri, so say di locals fit get jobs and oda opportunities.

Ghana's high commissioner says they are headed to court to challenge the legality of this action

Wia dis foto come from, MAYOR MDUDUZI MYEZA/FACEBOOK

Wetin we call dis foto, Di Mayor for Estcourt give foreigners 21 days to pack out from di area

One Ghanaian wey go viral afta some protesters harass am wey dem demand im immigration documents when im dey work for im shop, spark international concern.

Ghana authorities raise alarm about di incident wey dem condemn di harassment of di citizen – Emmanuel Asamoah wey dey do legal work for di kontri at di time.

Ghana foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa describe di incident as "unacceptable" wey im demand investigation by South Africa authorities.

Di govment since dat time don repatriate Emmanuel Asamoah to Ghana wey dem offer am job to start im life all ova again.

Ghana petition di African Union to discuss di issue of xenophobia for South Africa for dia mid-year coordination meeting wey go happun for Egypt in June.

Nigeria authorities also bin raise alarm about attacks on dia citizens for di kontri wey dem also begin to register pipo wey wan comot di kontri.

Oda kontris like Angola, Mozambique, Kenya, Ethiopia, Malawi, Lesotho and Zimbabwe don issue advisory to dia citizens to stay away from protest areas and keep safe as South Africans continue to dey protest for street.

South Africa president Cyril Ramaphosa condemn attacks on foreigners for im kontri but im deny say di kontri be xenophobic.

Im tok say even as di kontri gatz investigate di mata of harassment and attacks on foreigners, dia govment gatz deal wit di issue of illegal immigration and undocumented foreigners wey scata di kontri.

Ramaphosa say di plenti undocumented foreigners for di kontri dey put pressure for di small resources for di locals for some communities.

Despite dis, di United Nations (UN) and oda groups still dey call on South Africa to protect foreigners from attacks, in line wit di African Charter for Human and peoples' rights.

Charter flight dey carry di 300 Ghanaians comot South Africa Thursday morning

Ghana foreign ministry don confam say dem dey use charter flight to evacuate di citizens at 5 AM for di O. R. Tambo International Airport for Johannesburg.

Di pipo wey register wit di Ghana High commission for South Africa wey dem process dia documents and travel passports, be di ones wey go enta di flight.

Ghana authorities say di evacuation be free for di citizens – di kontris govment don fully pay for di service.

Di ministry say any oda pipo wey wan return to Ghana gatz contact di high commission to register make dem prepare to add dem to di next batch wey dem go evacuate from di kontri.

Foreign minister Samuel Okudzeto Ablakwa say "di welfare and safety of all Ghanaians be priority for di govment of Ghana" na so dem go do everitin to ensure dia safety.

"President John Mahama bin grant presidential approval for dis immediate evacuation of Ghanaians wey im wan make we ensure say no citizen dey harmed by protesters," di foreign minister tok.

Protests happun for Durban, Pretoria, Mthatha, Johannesburg and oda cities across di kontri wey dem still dey happun.

Di vigilantes and anti-immigration groups say dem go continue to protest till di end of di year.

In fact Ghana High Commissioner to South Africa Benjamin Quashie say di African ambassadors' network dey go to court to ask di mayor of di Estcourt to return di keys wey im seize from foreign shop owners for im municipality.

According to di high commissioner di mayor Mduduzi Myeza carry di keys wey im seize from more than 25 foreign shop owners to di locals say make dem operate di shops.

"Di mayor also give di foreigners 21 days to pack out from di area, we tink say wetin di mayor bin dey do be illegal"

Emmanuel Asamoah is re-integrated and has started a business

Wia dis foto come from, GHANA HIGH COMMISSION IN SOUTH AFRICA

Wetin we call dis foto, One businessman for Ghana open cement warehouse for victim of xenophobia for South Africa afta dem repatriate am to Ghana

Govment go give di repatriated citizens some financial package

Di foreign affairs minister oga Samuel Okudzeto Ablakwa say di Ghana govment go offer wetin im describe as "welcome home financial package" for di pipo wey dey evacuated to Ghana.

Im also announce oda tins for di citizens as dem arrive for di kontri.

Di govment go provide "transportation assistance" for dem to dia various locations across Ghana.

Dem also dey entitled to wetin di foreign minister describe as "re-integration allowance" as well as free psychological support.

Di govment agencies also go put dia names inside one database for jobs and oda start-up opportunities, so say dem fit apply for jobs.

Dis plans na to re-integrate dem for di society afta dia return from dia business and oda tins dem bin dey do for South Africa bifor.

Pipo already begin dey demand full disclosure about di financial commitment wey di Ghana govment dey pump for dis whole project.

But for authroities, dem say di immediate focus be to remove di Ghanaian citizens from danger and attacks, di oda tins go follow afta.