President Tinubu appoint 39-year-old professor as Jamb registrar to replace Oloyede

Wia dis foto come from, Bayo Onanuga/X
Nigeria President Bola Tinubu don announce di appointment of Professor Segun Aina as di new Registrar of di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB).
Di new Jamb registrar go replace Professor Is-haq Oloyede wey im two-term tenure go expire on July 31, 2026.
According to di statement by di President tok tok pesin Bayo Onanuga, di appointment of Segun Aina go now make history as Jamb youngest registrar.
According to di presidency, e dey expected say Oga Aina go bring im experience and knowledge into di operations of di Board.
President Tinubu also ant make di new Jamb registrar make educational organisation past wetin im predecessor achieve.
Oga Aina go takeova from Prof Oloyede wey assume duty as di Registrar of Jamb on 9 August, 2016.
Who be Professor Segun Aina
According to di presidency, Professor Aina go clock 40 years by July, and dat go make am di youngest registrar wey Jamb don get.
Oga Aina na Professor of Computer Engineering from Obafemi Awolowo University, Ile-Ife.
Aina get Bachelor of Engineering for Computer Systems Engineering from University of Kent, e get MSc in Internet Computing and Network Security.
E also get PhD in Digital Signal Processing, wey di two na from Loughborough University, United Kingdom and E complete di Senior Management Programme from Lagos Business School.
Aina begin im career wit Jamb during National Youth Service wia e gain foundational experience for national admissions and dat don help get contributions to examination reform.
We dey update dis tori









