Why protesters clash wit police as dem arrest ova 250 for France

Wia dis foto come from, Kiran RIDLEY / AFP via Getty Images
Protesters for France don burn one tourism office for Lyon as di kontri dey face major protests sake of dia education standards wey dey fall and cost of living.
Police for France don arrest more dan 272 pipo across di kontri sake of dis ogbonge demonstration wey dey hapun for Paris wey be di city centre and oda places.
Saturday protest dey continue from di three weeks of student-led protests across di kontri.
Students dey call workers unions and ogbonge pipo from di "yellow vest" movement to join dem.
Di French interior ministry don condemn wetin dem call "targeted act of violence" and dem accuse some protesters say dem dey try to loot and dem dey also attack police.
BBC Correspondent for Paris report say while some protesters for di capital dey ready to cause kasala, tori be say di pipo wey dey do di main march dey peaceful.
One group of young pipo tell di say BBC dem be "pacifists" wey "just dey try to change tins"
French President Emmanuel Macron don beg dem to "calm" down as e call on demonstrators to show "respect for pipo and property"
Videos show as pipo dey throw fire for di capital, Paris. or For Marseille pictures show as police dey spray tear gas sake of di protests.
One high school pikin tell Reuters say, "na joinbodi to make demands and social classes".
Di yellow vests wey be one of di pipo wey dey organize dis protests bin protests against high cost-of-living for ova one year for 2018.
Na dia website bin show wia hundreds of protesters go gada as dem bin dey plan di Saturday protest.
Dem also call farmers, workers, climate marchers and pipo wey don retire to come support di movement.
France bin close ova 500 schools sake of protests.

Wia dis foto come from, AFP via Getty Images

Wia dis foto come from, Reuters

Wia dis foto come from, Reuters
Apart from Macron, oda pipo for govment don chook mouth inside di mata of dis protests.
Dis week, Macron tok-tok pesin comot tok tok say im dey fear say di "correct" worry weu pipo dey get, political forces wan come kolobi am.
France Prime Minister Sébastien Lecornu bin tok dis week say im dey reason say na France left party La France Insoumise dey use dis students dem dia anger and manipulate am.
E tok on Wednesday say, na dem dey encourage di protests say "members of La France Insoumise dey use dis hih school movement for dia own electoral advantage".
Education Minister Édouard Geffray bin go wan school wey dem vandalise pieces on Thirsday dey beg protesters to stop di kasala say na only tok-tok go fit to solve dis mata.
Di president France hard right National Rally, Jordan Bardella before di protest say e dey worried.
According to tok-tok wey French tori pipo bin bring come outside, e say na "opportunity make di France wey kasala dey burst for so, just follow Jean-Luc Mélenchon".
But do Mélenchon neva tok pim on top dis mata. Even though im face don dey all ova di student rallies for inside di past few weeks.
Im party bin also share informate about Saturday protest for dia social media.
How dis protest mata take start?
Na heat cause am o, di mata start for September for low income Seine-Saint-Denis area of northern Paris wey don spread round di kontri
Di movement wey bin start nearly two weeks ago for low income Seine-Saint-Denis area of northern Paris don spread around di kontri.
E bin hot well-well on Thursday wia dem bin block hundreds of lycées (di place wey 15 to 18 year olds dey finish dia schooling).
Di situation bin beta small on Saturday but na 400 lycées dem bin close so dat dem fit protect staff and student.
Tori be say universities don begin join di protest.
Di students dey demand for money, more teachers, smaller classes and beta buildings.
Dis protest don cause ogbonge kasala wey lead to di burning of halls for di lycées and many teachers, students and even police pipo don wound.





















