South African police begin investigation as gunmen kpai eleven pipo inside house for Durban

Police dey for one crime scene

Wia dis foto come from, SAPS

Wetin we call dis foto, South Africa get one of di world highest murder rates
Published
Read am in 1 mins

Gunmen don kill at least 11 pipo for inside one mass shooting for one residential building near di South African city of Durban.

Di gunmen bin storm one house for KwaMakhutha township on Tuesday night, dem open fire on 14 pipo.

Ten pipo die for di scene and dem carry four go hospital, wia one later die from dia injuries, police tok.

Police tok say some of di victims bin dey on dia watch list in connection wit illegal activities, wey dem no fit "disclose at di moment to protect investigations wey dem don start".

While dem neva confam di motive for di shooting yet, police say dem no fit rule out "fight-fight between rival groupings".

Police for statement tok say di "Information wey dey available at dis stage suggest say 13 men and one woman, wey dem believe say get belle, bin dey do party inside one house, wen three men enta and open fire on dem."

Di woman dey among dow wey die.

One local TV reporter from eNCA channel for di scene tok say di gunmen bin put fire inside one motor wey belong to one of di victims bifor e run. Video show as di car burn totally.

South Africa get one of di world highest murder rates, as police data show murder rate wey reach more dan 60 deaths a day.

In recent weeks, di sad discovery of at least nine murdered women don increase fears for di kontri.

Last year, nine pipo die for mass shooting for one tavern for Johannesburg.

Rivalry among criminal gangs and serious fights, drug trafficking and illegal mining dey common for di kontri, and e often dey drive violence within communities.

For February, President Cyril Ramaphosa say organised crime na "di most immediate threat to our democracy, our society and our economic development", as e announce say im go send army to support di police.