How England fight dia way through to World Cup semi-finals and odas wey don qualify

Wia dis foto come from, Dan Mullan/Getty Images)
Jude Bellingham score twice as England come from behind to beat Norway 2-1 for extra time to reach di World Cup semi-finals.
Incredible 90 minutes of play wit 30 minutes of extra time played 15 minutes each till di last whistle blow by di referee.
Norway make history by reaching di quarterfinal for di first time afta dem beat Brazil 2-0 to comot di Seleccao.
Erling Haaland na di star for di Vikings as im score seven of dia 11 goals for dis tournament.
Di first goal come in for Norway for di 36 minutes, wen di ball come out wide to Andreas Schjelderup and e be like e wan cross di ball for Erling Haaland but instead e fly am into di top corner of di net.
But di added times bifor di half-time, brilliant play down from di left by Elliot Anderson wey drive forward and find Anthony Gordon, wey come cross into di box for Jude Bellingham.
Dat way, di two teams get 1-1 level goal. By di extra-time wen di two teams no find goal, Bellingham find di back of Norway net to lead di game till final whistle.
Bellingham don emerge as one of di stars of England run to di World Cup semi-finals - and e arguably dey part of di best players of di tournament.
Six goals, including a brilliant double against Norway in the quarter-finals, plus an excellent assist for Harry Kane's goal in the 2-0 win over Panama has had England's supporters serenading the 23-year-old here in the USA.
World Cup semifinals match
- Spain vs France
Dis match go happun for 14 July, for Dallas wia dis two world-class teams go face diasef.
Spain reach di quarterfinal of di World Cup for di first time since 2010 wen dem win di trophy for South Africa.
But now, dem dey di semi-final for 2026 World Cup.
For Spain, dia starboy Lamin Yamal dey fit, wey im go hope to inspire La Roja togeda wit Rodri, Pedri, Alex Baena and di odas.
Spain no concede goal for dis world cup until afta five games.
For France, dem be one of di favourite for dis tournament according to many pundits.
Les Bleus get firepower for dia team wit dia captain Kylian Mbappe wey get eight goals for di tournament.
Dem also get Michael Olise wey get di highest assists for di competition, togeda wit Ballon D'or winner Ousmane Dembele wey get four goals.
- England vs Argentina/Switzerland
Dis game go happun for Wednesday 15 July, wia di two world-class teams go jam diasef for Atlanta stadium.
Meanwhile, di defending champions go jam wit Switzerland afta dia historic R16 comeback against Egypt when dem win 3-2 afta dem bin dey lose 2-0 afta 78 minutes.
Lionel Messi once again inspire im team wit one goal and one assist; di Argentine star now get eight goals and two assists for di tournament.
Switzerland defeat Colombia for penalties for di R16 to reach di quarterfinal.
Di Swiss also sama Algeria 2-0 for di R32. Dis be Switzerland first quarterfinal since 1954.
As underdogs for dis quarterfinal game, di Swiss dey hope to use dia performance against Colombia as motivation.
Argentina and Switzerland bin face each oda seven times – Argentina win five wey dem draw two.







