How man almost comot from plane through window of aircraft wey still dey fly
- Author, Jaroslav Lukiv
- Author, Theo Leggett
- Published
- Read am in 3 mins
One passenger almost comot from aircraft through window of Ryanair plane wey still dey fly.
Witnesses tell local media say di head of di man down to di shoulders, bin hang for air for several minutes, bifor oda passengers on di flight manage to pull am back inside di plane.
According to tori, di man come from Serbian and e dey im 60s.
For one statement, Ryanair say on Friday morning flight from di Greek city of Thessaloniki to Germany Memmingen bin return "shortly afta take-off wen one passenger window bin dislodge inflight".
E continue: "Di aircraft land normally and passengers return to di terminal. One passenger ask and receive medical assistance on di ground for Thessaloniki."
Di Irish budget airline add say "dem arrange replacement aircraft to bring passengers to Memmingen" several hours later.
Media reports for Greece and Germany bin quote passengers wey tok say dem hear one loud bang, den dem hear as window break and oxygen masks begin fall from di ceiling shortly afta di Boeing 737 take off.
Dem believe say na di jet engine smash di window into pieces - although Ryanair no comment on am.
End of Di one wey oda users dey read well well
"We immediately notice decompression. Pipo dey shout... for a moment I bin tink say pesin mistakenly open di emergency door," Christina, one fellow passenger, tell Radio Thessaloniki.
"Di masks drop and one strong smell follow. Di head and shoulders of one passenger dey outside di window. Fortunately, e neva remove im seat belt."
Ryanair subsidiary Malta Air na im dey operate di aircraft - wey dem believe say na 18 year-old-plane.
Di Irish Aviation Authority (IAA) later tell BBC say dem dey "aware of di incident wey involve Ryanair group aircraft, wey Malta Air dey operate".
"Di IAA go provide any requested assistance give di aviation safety investigation authority for Greece and di Maltese Civil Aviation Directorate, to aid dia investigation," dem tok.
For 2018, one passenger die wen debris from one damaged engine cause di window to break for one Southwest Airlines flight for US.















