Attacks wey don happun for Nigeria afta Tinubu visit Plateau State

Bola Tinubu during visit to Jos

Wia dis foto come from, Presidency

    • Author, Abubakar Maccido
  • Read am in 4 mins

On Sunday 2 April, President Tinubu visit Plateau State afta one serious attack by gunmen wey kill many pipo.

For im visit, e assure say dis kain attack no go happun again, and President Bola Tinubu come direct all service chiefs make dem identify and bring to justice di killers wey dey behind di recent attacks for Plateau State.

E also promise say govment go install 5,000 cameras to improve security surveillance for Plateau State.

Days afta e make dat comment, several deadly attacks don happun across differen parts of di kontri.

Time line of attacks wey happun afta Tinubu visit Plateau State

On 5 April, gunmen wey dem say be members of new terrorist group wey dem call Mamudawa attack communities for Shanga Local Govment Area of Kebbi State, cause loss of lives and property.

Police tok tok pesin for Kebbi, SP Bashir Usman, confirm di attack.

E tok say on di night of 5th April 2026, suspected Mamudawa terrorists attack Gebe, Kawara, Kalkami and nearby villages for Shanga Local Govment Area, take advantage of di wetland terrain. Parts of di communities burn and lives lost.

E add say security forces, including Police Tactical Units, Military, Marine Police and local vigilantes, don deploy to restore normalcy, secure di affected areas and protect residents.

Operations still dey go on, and dem urge di public to remain calm as more updates go come as di situation dey develop.

Sunday 5 April, gunmen attack for Benue North Central Nigeria kill 17 pipo while many odas wunjure.

Amnesty International condemn di latest attack for Benue State wia 17 pipo kpai for Mbalom in Gwer East Local Govment Area. Gunmen invade di village on Sunday during Easter celebration, leave many pipo badly injured.

"Apart from killing pipo, di gunmen also burn many houses and shops. Families still dey search for people wey miss since di attack" Amnesty tok.

According to Amnesty, for Benue State, attacks by gunmen don displace over 500,000 people, many of dem dey live for poor camps without enough water, sanitation, food and healthcare.

While for Kaduna State, terrorists attack two Christian churches for Ariko Village, Kachia Local Government Area, kill five worshippers and kidnap 31 odas.

Di victims later get rescue by Nigerian Army troops afta quick operation, though di attackers escape wit heavy casualties.

On 4 April, dem report say 11 pipo die on Friday, while more dan 50 houses burn for fresh attack by hoodlums for Nasarawa communities.

Di incident wey happun early morning involve hoodlums wey carry out suspected reprisal attack over alleged killing of two of dia pipo.

About 50 houses burn for Akyawa, while two odas burn for Udege Kasa.

For statement on Saturday, Police tok tok for Nasarawa State Command, SP Ramhan Nansel, tok say Commissioner of Police for Nasarawa State, CP Shetima Mohammed, visit di communities and express deep sorrow over di incident.

E assure say justice go be served afta di attack.

On 3 April, bandits kidnap more dan 150 residents from Kurfa Ɗanya and Kurfan Magaji villages for Bukkuyum Local Govment Area of Zamfara State.

Di lawmaker wey represent Gumi/Bukkuyum Federal Constituency for House of Representatives, Suleiman Abubakar, confirm di incident to BBC Hausa Service, say di attack happun late Thursday night.

According to am, di terrorists carry out coordinated midnight attack, kidnap villagers while dem dey sleep.

E add say so far, all di pipo for di towns don run leave dia homes, and dem dey displaced within Bukkuyum town.

E kontinu say Bukkuyum, Gumi and Anka local govment areas don dey suffer from attacks by bandits wey dey kidnap pipo for ransom.

Hon Abubakar call on federal govment to focus on security challenges for Zamfara State.

On 3 April, suspected terrorist wey dem say come from Rankum (Mahanga) area launch attack for Jol community for Riyom Local Govment Area, kill 51-year-old Dalyop Betobeje.

Dis latest incident come afta anoda deadly attack for Heipang District for Bassa Local Govment Area.

President Tinubu, during im short visit to Plateau on Wednesday, assure victims of violence and residents say Federal Govment go end di cycle of killings and restore lasting peace.

"I promise una say dis experience no go happun again," di President tok while e dey sympathise wit affected families.

However, Thursday renewed violence for Riyom and di earlier attack for Heipang don cast doubt on dos assurances, show say urgent and serious security action dey needed for di state.