2019 Wildlife Photographer of the Year competition: Rodent wey fight fox win best foto award

Grand Prize Winner
Published

At first you go tink say di photo na subject of funny caption competition, but di koko be say dis foto of fight between fox and one rodent na im win di 2019 Wildlife Photographer of di Year competition.

Foto journalist Yongqing Bao from China na im tak di pishure wey win di 2019 edition of di competition out of di many wey submit dia work from around di world.

For di foto, di fox don surprise di animal wey oyibo dey call marmot and ogbonge fight wan almost start, fight wey di rodent go end up not surviving.

Not even di rodent mama fit safe am.

Yongqing Bao title di standoff between di Fox and rodent as di 'Moment'.

Oda fotos wey receive accolades

Squid
Wetin we call dis foto, Cruz Erdmann wey be 14 years na im take dis foto of squid wey see am win di Young Wildlife Photographer of the Year title
Presentational white space
Land of di eagle by Audun Rikardsen
Wetin we call dis foto, Imagine say you fit fly like eagle! Audun Rikardsen na im take dis one
Presentational white space
The huddle by Stefan Christmann
Wetin we call dis foto, Stefan Christman catch more dan 5,000 male emperor penguins for im camera wen dem gada togeda for sea of ice for Antarctica Atka Bay.
Presentational white space
The rat pack by Charlie Hamilton James
Wetin we call dis foto, Charlie Hamilton win Urban Wildlife foto for 2019, take dis foto wey im title 'di rat pack' wen im bin go Manhattan, New York
Presentational white space
The architectural army by Daniel Kronauer
Wetin we call dis foto, Daniel Kronauer win di 2019, Behaviour foto of Invertebrates, im title dis one as di 'architectural army'.
Presentational white space
Snow exposure by Max Waugh
Wetin we call dis foto, Snow exposure by Max Waugh win di Black and White foto category wit dis pishure of Bison wey dey find grass inside snow
Presentational white space
Snow-plateau nomads by Shangzhen Fan
Wetin we call dis foto, Snow-plateau nomads by Shangzhen Fan bag di 'Animals in dia Environment' category for 2019
Presentational white space