Comedy Wildlife Photography Awards 2018: Squirrel wey shock and oda funny foto dem dis year

Published

One foto of squirrel wey shock don win di overall prize for dis year Comedy Wildlife Photography Awards.

Out of thousands wey send dia pishure enta di award from around di world, Mary McGowan, from Tampa, Florida, win wit her foto wey she title: Caught in di Act.

See some of di funny foto dem wey win and di ones dem clap hand for say dem try wella.

Winning foto dem

Shocked squirrel
Wetin we call dis foto, Mary McGowan foto of squirrel wey shock na di overall winner. E also win for di People's Choice and Creatures of di Land awards
Presentational white space
Owl peeking
Wetin we call dis foto, Shane Keena win di Creatures of di Air prize wit dis foto of owl
Presentational white space
Shark
Wetin we call dis foto, Smile for di camera! Tanya Houpperman win di Under di Sea category wit dis foto of shark wey dey shine teeth
Presentational white space
Perched owl
Wetin we call dis foto, Dis owl for Kapurthala, India, win Arshdeep Singh di Junior Award
Presentational white space
Three bear cubs on a tree trunk with an adult bear on the ground
Wetin we call dis foto, Valtteri Mulkahainen win di Amazing Internet Portfolio category wit pishures of family of brown bears for Finland

Foto dem wey receive accolades

A rhino with peacock feathers behind it
Wetin we call dis foto, Dis rhino wey dey like e wear peacock-feather tutu for Kallol Mukherjee na for Gorumara National Park, India dem snap am
Presentational white space
Bear holding a paw against its face
Wetin we call dis foto, Dis bear wey dey vex na Danielle D'Ermo snap am for Alaska
Presentational white space
Polar bear looking at a camera on a tripod
Wetin we call dis foto, Roie Galitz site dis ogbonge photographer for Svalbard
Presentational white space
Squirrel holding on to plants with its feet
Wetin we call dis foto, Geert Weggen snap dis red squirrel wey dey do splits for Sweden
Presentational white space
A moose blowing a raspberry at another moose
Wetin we call dis foto, Moose wey Barney Koszalka snap for Wyoming, US
Presentational white space
Two embraced lizards
Wetin we call dis foto, Two lizards wey dey like dem dey dance for Wilpattu, Sri Lanka. Na Sergev Savvi snap am
Presentational white space
Two monkeys fighting
Wetin we call dis foto, Sergey Savvi also snap dis two dusky leaf monkeys wey be like dem dey do chaki chan for Kaeng Krachan National Park, Thailand

Di Comedy Wildlife Photography Award dey release book, wey dey help support di Born Free Foundation charity.