Di advantage wey PSG get pass Arsenal as dem go face off for di Champions League final

Arsenal manager Mikel Arteta and PSG boss Luis Enrique

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Arsenal dey ginger to win dia first Champions League on Saturday
    • Author, Chris Adams
    • Role, BBC Sport journalist
  • Published
  • Read am in 4 mins

Wen di best teams for England and France go jam demsefs for di Champions League final on Saturday, e go be ogbonge end to veri tough season for di two clubs.

Di match wey go hold for Budapest Puskas Arena na Arsenal 63rd game for di campaign. Dis na as till last month dem bin dey chase four trophies.

But for Paris St-Germain, na dia 56th match if you no add di seven dem play for last summer Club World Cup.

Wit World Cup around di corner, rest no dey for di elite players on both sides. But, by one measure, na di French club stars dey enta di contest fresher.

Di tin be say Luis Enrique bin rest many of im key players for di Ligue 1 games dis season.

Di reason wey e bin dey able to run dis kain parole na bicos di opposition for house bin dey weak and also di depth of di squad wey im don build wit di plenti money wey di Qatari owners of di club dey provide.

Bicos dem finish 11th for League, PSG play 16 Champions League games to reach di final while Arsenal bin play 14 matches.

From di players wey bin play for di two teams semi finals second leg, Mikel Arteta starting 11 bin get almost 7,000 extra minutes of playing time for league games dis season (6,726 to be precise).

Some of the numbers for individual players dey interesting to watch.

Les Parisiens club captain Marquinhos bin start for 14 of di European games. Dis na di same number of total appearances wey e make for di league (11 starts, three as a substitute).

From 13 February to 19 April, di Brazil defender no play at all for league as dem leave am for bench as unused sub for seven back-to-back games, For dat time e play all di six Champions League fixtures.

Ballon d'Or holder Ousmane Dembele bin finish 90 minutes for league only once for 22 appearances. Fellow forward Khvicha Kvaratskhelia bin play 90 minutes matches just two times for 28 matches.

On 12 May, Dembele bin win di Ligue 1 player of di season award for di second year in a row as im bin register 10 goals and seven assists.

E bin start for just 11 league games (nine games by di time e gbab di award) and play for 22 to possible 34 overall. But na injury keep am from 10 of dem.

Luis Enrique policy of rotation wia e use 28 players for league to Arteta 25 bin come at cost even though e no be telling one.

Three out of dia six league defeats bin come afta Champion League ties. Dis na against Marseille for September, Monaco for November and Lyon for April.

Midfielder Warren Zaire-Emery bin play more league minutes pass any oda player for PSG wit 2,453 minutes but six Arsenal players pass dat time for field.

Note say PSG bin play up to 58 games last season to gbab four trophies including dis first Champions League success wen dem sama Arsenal 3-1 on aggregate for semi-final. Di Ligue 1 campaign also dey four games less dan Premier League own sake of say dem dey play 18 team format.

Arsenal players don dey earn dia pay well-well. Goaalkeeoer David Raya don play all through di season till e rest for di final match against Crystal Palace as dem don alreadi bag di title.

Declan Rice, William Saliba, Gabriel and Martin Zubimendi also bin start for at least 30 league games for Arsenal, dis na somtin wey only Zaire-Emery for PSG bin do. Even di Gunners Jurrien Timber wey don wound since mid March and wey e neva sure for am say e go dey finals don clock more minutes dan am.

Out of di 10 players wey get di most league minutes for di two clubs dis season, na just two of dem wey be Zaire-Emery and Illia Zabarnyi, bin come from PSG.

PSG don win Ligue 1 for 12 of di last 14 seasons, dem bin lift di trophy just twice bifor di govment of Qatar operated Qatar Sports Investments organisation bicom di club only owner for 2012.

Arsenal, however, just finish dia 22 years wait to bicom di champions of England again. Dis mean say di two finalists get 14 league titles.

PSG get di numbers advantage for Champions League wins. E fit change on Saturday.