Arsenal win 2025/2026 Premier League title

Kai Havertz of Arsenal celebrates scoring his team's first goal with teammates during the Premier League match between Arsenal and Burnle

Wia dis foto come from, Alex Burstow/Arsenal FC via Getty Images)

Published
Read am in 2 mins

Arsenal don win di 2025/2026 Premier League title.

Arsenal 22-year wait for di Premier League title end afta rivals Manchester City draw for Bournemouth, for wetin fit be Pep Guardiola second to di last game in charge.

Tuesday result on di south coast leave Mikel Arteta men four points clear of City before di final round of games go hold on Sunday, wit di Gunners wey don ready to carry di trophy for Crystal Palace.

Build-up to dis game bin don see tori say Guardiola ready to step down as City manager at di end of dis season.

E tell tori pipo before di game say rumour over im future get "absolutely zero" impact on preparations, but di brilliant Cherries play pass dem, wey extend dia unbeaten run to 17 matches.

Na teenager Junior Kroupi score Bournemouth goal six minutes before half-time on Tuesday night.

Home goalkeeper Djordje Petrovic make important save to deny Nico O'Reilly early for second half and although Erling Haaland score late equaliser, di hosts hold dia side.

Bournemouth boss Andoni Iraola announce say im go comot at end of dis season - and dis result ensure say di Spaniard don help dem to achieve di marvelous achievement of securing European football for next season.