Wetin we know as police find 28 human skulls and bones for Abia state

Bones found in Abia state
Published
Read am in 3 mins

Di Abia State Police Command say dem don recova twenty-eight (28) human skulls and human bones from one forest for di state.

Abia State Police tok tok pesin Maureen Chinaka say dia investigation wey dem conduct on Sunday, September 27, 2026, lead to di discovery.

Dem say di investigation na sake of dia securiti operation under di name "Operation No Hideout for Criminal Elements for di State".

Di police say dem dey on mission to comot all di bad pipo and criminal elements wey dey di state.

Na combined efforts of di Violent Crime Response Unit (VCRU), Anti-Kidnapping Unit, Anti-Cultism Unit, Intelligence Response Unit (IRU), Rapid Response Squad (RRS) and di Isuochi Police Headquarters bin lead to how dem discova di humans skulls and bones.

Police say dem find di remaining parts of human bodies for inside forest for Isuochi and Nneato community under Umunneochi Local Govment Area of ​​Abia State.

How dem find out be say dem begin intelligence-raid across di state to places wia dem suspect say bad pipo fti dey hide.

Di tok tok pesin say dem "deploy to suspected criminal camps wey dey located for di forests for Umuaku, Isuochi, for bush-combing operations, as well as anoda camp at Nneato, Isuochi."

Police say dem suspect say di bones belong to pipo wey dem kidnap and hide for inside forest for di two locations.

Dem say di bad pipo sharply run comot wen dem see say di police don land.

"Upon arrival of di Command tactical operatives at di camps, di suspects run. Di criminal camps dey subsequently scatta," police say.

Na during di time wey dem enta di kidnapper location, na dia dem find di human skulls and bones wey some of dem don rotten.

"Total of twenty-eight (28) human skulls and bones, wey we suspect say na kidnap victims, dey recovered."

Police say dem neva gbab anybodi yet since di pipo wey dem find don run go, but dem go begin investigation.

"Investigation dey go on, while monitoring of di area kontinue, and efforts dey high to catch di suspects wey dey on di run," police.

For videos and fotos wey police share show how di bones and skulls dey for ground inside di bush.

Umunneochi area don previously feature for security operations wey dey target suspected kidnappers.

For recent years, authorities conduct raids around di cattle market area of di local govment wia dem recova decomposing bodies wey dem also say e dey linked to kidnapping activities.

Abia Police Command say dem o go allow jaguda pipo to come scatta di state as no place to hide for dem for Abia.

Dem say make pipo report anytin wey dem see wey concern securiti situation for di state.